Former President Goodluck Jonathan return to Nigeria afta Guinea-Bissau coup

Former Nigeria President Goodluck Jonathan

Wia dis foto come from, Goodluck Ebele Jonathan/X

Read am in 4 mins

Former Nigeria President Jonathan wey bin for Guinea-Bissau wen di military takeover through coup, don return back im kontri.

Pipo bin dey ova di safety of Oga Jonathan wey di tori of di coup'd'etat break and e dey di kontri wen e army group arrest Guinea-Bissau president.

Na di presidential jet of Ivory Coast carry Nigeria former leader come back.

Former president Jonathan arrive wit im team for di Nnamdi Azikiwe international airport for Abuja on Thursday evening.

Earlier, tok-tok pesin for Jonathan, Ikechukwu Eze confam to BBC News Pidgin say oga Jonathan dey okay and e go leave wen e get clearance to comot Guinea-Bissau.

Eze clarification come afta tori spread say di former Nigerian leader "dey trapped" for di West African nation afta di coup d'etat wey hapun for di kontri on Wednesday, 26 November.

Oga Jonathan dey among di African leaders wey dey on di joint mission of di African Union, di Economic Community of West African States (ECOWAS) plus di West African Elders Forum wey dey di coup-hit Guinea-Bissau to monitor di presidential election wey hold on Sunday, 23 November.

Di military officers wey seize control of Guinea Bissau announce say dem don close all dia borders and compulsory night time curfew, so nobody go fit comot.

Meanwhile, Nigeria House of Representatives don ask di Nigeria govment to use all diplomatic efforts to ensure di return of di former leader.

Di House bin make di call during plenary session on Thursday, 27 November. Di lawmakers also urge di govment to also rescue oda Nigerians wey dey di kontri.

Sojas wey carry out coup for Guinea Bissau dey give address on TV

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Na on Wednesday, 26 November, one group of military officers bin say dem don seize control of Guinea-and arrest di president, Umaro Sissoco Embaló.

Di officers wey appear on state TV, tok say dem don suspend di electoral process, as di West African nation bin dey await di outcome of di presidential election wey hold on Sunday.

Dem tok say dem act to scata plot by unnamed politicians wey get "di support of a well-known drug baron" to destabilise di kontri.

Di coup-prone kontri dey known as notorious drug-trafficking hub wia di military dey influential since independence from Portugal for 1974.

Dem bin dey expect di election results on Thursday - both Embaló and im closest rival Fernando Dias bin don claim victory bifor di coup.

AU and Ecowas react to coup

For inside one joint statement, leaders of election observation missions from di African Union and di West African bloc Ecowas don express "deep concern wit di announcement of a coup d'etat by di armed forces".

Dem say di kontri bin dey prepare for di announcement of di election results afta wetin dem describe as "orderly and peaceful" process.

"E dey regrettable say dis announcement dey come at a time wen di missions bin just conclude meeting wit di two leading presidential candidates, wey assure us of dia willingness to accept di will of di pipo," dem tok.

Earlier, witnesses for Bissau bin hear gunfire at around 13:00 GMT, but e no dey immediately clear who bin dey involved for di shooting or if any casualties dey.

Hundreds of people wey dey waka and dos wey dey inside car run, dem dey find wia to hide, as di shooting bin dey go on, AFP news agency report.

Later on, General Denis N'Canha, head of di military household for di presidential palace, bin read out one statement declaring a takeover.

E say officers don form "di High Military Command for di Restoration of Order" and dem instruct di population to "remain calm".

Dem don erect checkpoints across Bissau and di streets dey deserted ahead of di curfew, wey go start at 19:00 GMT.

Portugal don call for a return to constitutional order, as dia foreign ministry urge "all dos wey involve to refrain from any act of institutional or civic violence".

Di former Portuguese colony don witness at least nine coups or attempted coups ova di last five decades.

Embaló don survive multiple coup attempts during im time for office. However, im critics allege say im fabricate crises in order to crack down on dissent.

Di 53-year-old bin wan make history as di kontri only president to secure a second consecutive mandate for di last 30 years.

Initially, e bin tok say im no go run for a second term. Bifor di delayed polls, pipo bin don question im legitimacy, as di opposition tok say im term suppose don officially end for February 2025.

Guinea-Bissau na one of di poorest countries for di world wit a population of more dan two million pipo.

Di kontri coastline get many uninhabited islands, wey make am ideal for drug traffickers - di UN dubb am as "narco-state" as na key transit point for cocaine wey dey come from Latin America to Europe.