Coup plotters for Nigeria history and wetin happun to dem

Collage image of Chukwuma Nzeogwu, Murtala Muhammed, Joseph Garba and Ibrahim Babangida

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Read am in 7 mins

Recent tori about investigation of 16 senior officers don kontinu to generate tok-tok.

Di Nigeria Defence Headquarters don already issue statement to clear say tori about coup attempt no be true.

Di DHQ also say "di ongoing investigation involving di 16 officers na routine internal process to make sure say discipline and professionalism dey maintained within di ranks".

Even afta dis explanation, di tori still dey strong among Nigerians as some local tori pipo kontinu to insist say dem get ogbonge informate say dis kain tin bin happun.

For kontri like Nigeria wey don experience plenty coups in di past, including di ones wey soja pipo kpai di leaders and take ova, e no dey surprising say pipo go para wen dem hear tori say anoda coup bin wan happen.

Between di time of Nigeria independence for 1960 and 1999, di kontri don witness more dan 10 coup d'etas and plus alleged coup attempts wey fail.

Dis tori na about di pipo behind some of di coups wey don happun for Nigeria and wetin later happun to dem:

Chukwuma Kaduna Nzeogwu - January 1966 coup

Chukwuma Kaduna Nzeogwu

Wia dis foto come from, Nigeria Archive

Wetin we call dis foto, Major Chukwuma Kaduna Nzeogwu dey widely regarded as di leader of di first coup d'etat for Nigeria

Patrick Chukwuma "Kaduna" Nzeogwu na Major for di Nigeria Army and na im be di major planner of di first coup d'etat for Nigeria on 15 January 1966, less dan six years afta di kontri independence.

Na dis coup comot di democratic leaders of Nigeria dat time; Nnamdi Azikiwe wey be President - who bin travel out of di kontri - and Tafawa Balewa wey be Prime Minister - who sojas kill during di coup.

Major General Aguiyi Ironsi come take ova power afta di coup but im time for office last just six months bicos anoda coup comot am for power.

As for Major Nzeogwu, govment later arrest am and send am to Kirikiri prison for Lagos, bifor dem later transfer am to Aba prison.

E dey for prison until di Nigeria-Biafra civil war start in 1967, and di leader of di Biafra Soldiers, Odumegwu Ojukwu release am for March dat year.

Nzeogwu die for battle on 29 July 1967 for di Nsukka area of Enugu State.

Murtala Ramat Muhammed - July 1966 coup

Dis coup wey Murtala Muhammed carry for head, dey regarded as retaliation for di January 1966 coup.

Muhammed wey also be Acting Lieutenant Colonel dat time, bin join di Nigeria Army in 1958 and dey commissioned in 1961.

Afta di coup, Yakubu Gowon bicom di Head of State, even though tori be say Murtala Muhammed bin want di post for imsef.

Oga Muhammed no suffer any consequence sake of dis coup, e kontinu im military career and even later bicom di head of state.

But e also die for coup attempt by some sojas wey dia leader name na Bukar Suka Dimka, on 13 February 1976.

Joseph Nanven Garba - July 1975 coup

Joseph Garba wit im military regalia

Wia dis foto come from, Photo12/Universal Images Group via Getty Images

Wetin we call dis foto, Joseph Garba bin give di radio broadcast to announce di coup on 29 July 1975, e later bicom one of Nigeria most successful diplomats

Dis coup dey bloodless bicos di sojas no kill anybodi as dem take over power.

Na group of junior soldiers bin caary out di coup, but di main pesin wey announce am on top Radio Nigeria dat time na Joseph Nanven Garba, which na why pipo regard am as di leader.

Yakubu Gowon bin travel to Uganda to attend one meeting of di Organisation of African Unity (OAU), wen di sojas take ova power and announce Murtala Mohammed as di new head of state, and Olusegun Obasanjo as im deputy.

Dia vex be say dem no dey satisfied wit di slow process of Gowon to retun Nigeria to democratic rule.

Oda popular names wey follow for dis bloodless coup na officers like Theophilus Danjuma, Muhammadu Buhari, Ibrahim Babangida, and Sani Abacha.

As for Joseph Garba, afta di coup, e move more into diplomacy as Murtala Muhammed appoint am as Nigeria foreign minister.

Im diplomatic career take am into di United Nations wia e bicom di President of di United Nations Security Council by January 1978, Permanent Representative to di UN by 1984, and President of di UN General Assembly by 1989.

By di time e die, on 1 June 2002, Garba bin dey work as di Director General of di National Institute for Policy and Strategic Studies for Nigeria.

Bukar Suka Dimka - 1976 coup attempt

On 13 February, 1976, one group of sojas wey say dem be "young revolutionaries" attempt to take ova power.

Dia leader na Bukar Suka Dimka wey be Lieutenant Colonel dat time and dem block di Head of State Murtala Muhammed for traffic along di road and shot am die.

For dia radio broadcast afta dem kill di head of state, Dimka accuse Murtala Muhammed of corruption, indecision, and weakness.

However, di coup no succeed bicos majority of di sojas no support am.

E no waste time, oda sojas rally round and stop di coup plot, and from di Radio Nigeria premises wia e bin do di broadcast, Dimka pick race.

Three weeks later, security pipo arrest am around Abakiliki, Ebonyi State, for di southeast region of di kontri.

Di army court martial Dimka and six oda members of di coup plot, and sentence dem to death by firing squad.

On May 15, 1976, dem kill di seven of dem for Kirikiri prison.

1983 coup

Dis coup no get any particular leader, according to wetin plenty historians don write, but di major beneficiary na Muhammadu Buhari who bicom head of state afta di sojas overthrow di democratic administration of Shehu Shagari.

Oda names wey dey mentioned for di coup na soldiers like Colonel Tunde Ogbeha and Brigadier Ibrahim Bako wey bin lead sojas to di Presidential Villa to arrest Shagari, but members of di presidential guard fight dem back and kill Bako during di gunfire.

Buhari, who later again run for President of Nigeria and win in 2015, claim say im hand no dey for dat coup, but pipo wey don write about di incident say im bin dey aware.

Ibrahim Babangida - 1985 coup

Ibrahim Babangida as e take salute for im military uniform

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Ibrahim Babangida bin comot Muhammadu Buhari from power for bloodless coup in 1985

Just like wetin happun in 1975, di coup of 27 August 1985 bin no involve killing di head of state.

Ibrahim Badamosi Babangida wey lead di plot, na di chief of staff to di head of state Muhammadu Buhari.

Babangida remain for office until 1993. E even survive anoda coup plot in 1990 led by Gideon Orkar.

Gideon Gwaza Orkar - 1990 coup attempt

Gideon Orkar na Major for di Nigeria Army wen e lead di attempt to comot Ibrahim Babangida for power on 22 April 1990.

Orkar and im men bin succeed to take ova di military headquarters and Dodan Barracks wia di President dey live, but Babangida manage to escape di attack.

As di coup no succeed, Orkar and plenty odas, including civilians, bin dey arrested, and on Orkar and on 27 July 1990, dem kill 47 of di sojas by firing squad.

Sani Abacha - 1993 coup

General Sani Abacha official presidential portrait

Wia dis foto come from, Nigeria High Commission

Dis na anoda bloodless coup or 'palace coup' as some sabi pipo dey call am, and e happun on 17 November 1993.

Sani Abacha, wey be Major General for di Nigeria Army dat time, na also di Minister of Defence.

Nigeria bin just finish general election on June 12 1993, and plenty pipo including international observers tok say e dey very free, but di head of state Ibrahim Babangida bin cancel di election.

Afta e cancel di election, protests start for all ova di kontri so Babangida no get any choice dan to resign, and e appoint Ernest Shonekan as di interim President in August.

Less dan three months later, General Sani Abacha just sweep aside di interim president Shonekan and take ova power.

Abacha remain for power until e die on 8 June 1998.

Afta Abacha death, Abdulsalami Abubakar bin take over briefly as military head of state, but e hand over to President Obasanjo on 29 May 1999, and since den, coup neva happun for Nigeria again.