More dan 5,000 flights canceled, schools closed as major storm hit part of US east coast

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Parts of di US east coast don see over 22 inches of snow fall, according to di National Weather Service, after one major storm hit am.
Winter storm warnings don stretch from North Carolina to northern Maine, with warnings also wey dey in place for parts of eastern Canada.
More dan 5,000 flights in and out of US don dey cancelled so far on Monday, and hundreds of thousands of pipo dey without power
For New York City, where non-essential travel dey banned until midday local time (17:00 GMT), di snow bin dey shin-deep.
Video show di Empire State Building as di snow storm cover am overnight.
Up to 2ft (60cm) of snow dey expected in some places.
Na di first time in nine years wey New York City dey under a blizzard warning.
Dem don warn about 40 million pipo about di weather including residents for New York City, Boston, Philadelphia, and Long Island, while anoda 19 million dey face winter storm warnings.
New York City, New Jersey and Connecticut dey among di areas wey don declare states of emergency, wit up to 24 inches of snow wey dem expect to fall for some part of di region, according to National Weather Service.
As at midnight local time (05:00 GMT) on Monday, some of di north-east don dey covered wit several inches of snow - wit 10 inches for some areas of New York and New Jersey.
New York City Mayor Zohran Mamdani don issue travel ban, meaning only essential vehicles dey allowed to move for roads and bridges throughout di five boroughs, from 21:00 local time Sunday to 12:00 Monday. All schools for di city go dey closed on Monday.
'Avoid all non-essential travel', NY Mayor tell New Yorkers
Dem don shut down all streets and bridges to non-essential traffic for New York city, di most populous city for US from 21:00 on Sunday (02:00 GMT) to midday on Monday (17:00 GMT).
Mayor Zohran Mamdani tell tori pipo on Sunday say schools go close and all streets, highways and bridges go dey closed, apart from emergencies. Di travel ban go include e-bikes - wey pipo dey use for food delivery in di city. Di city dey under blizzard warning for di first time in nine years, wit 18 - 24 inches of snow wey dem dey expect.
"We dey ask New Yorkers make dem avoid all non-essential travel. Abeg, for your safety, make una stay for house, stay off di road," Mamdani tok. Dis na di second serious winter storm wey don hit di city dis year, afta 19 pipo die during di three-week cold wey start for 19 January.
Wetin be blizzard?

Wia dis foto come from, CHARLY TRIBALLEAU/Getty Images
Blizzard na winter storm wia heavy snow dey fall or snow dey blow wit ova 35mph (56km/h) wind to create visibility for less dan one quarter of a mile (402m) for three hours or more, according to di National Weather Service.
For US, blizzard dey common in di Great Plains and Midwest, especially for one place wey dem dey call "Blizzard Alley", e include parts of North Dakota, South Dakota, Minnesota, Iowa, Nebraska, southeast Wyoming, and eastern Colorado.
Na becos dis areas dey flat, wit no tree or any obstruction wey fit block wind and blowing snow.
Di last time New York City face blizzard warning na nearly one decade ago for March 2017. For Philadelphia, di last one na January 2016. Di last time wey di entire state of New Jersey state dey under blizzard warning na 1996.
Dis Sunday storm dey come afta anoda major snowstorm hit di region for January and cover New York City wit almost one foot of snow. But dat storm no get di associated wind wey fit make dem consider am as blizzard.
'We dey face serious mess': Electricity providers dey battle thousands of blackouts
Power outages affect hundreds of thousands of pipo for north-east US right now, according to di live tracker Power Outage.
Dis include 122,000 customers for New Jersey, 99,000 for Massachusetts, and 71,000 for Delaware, as of 07:00 EST (12:00 GMT).
One electric company wey base for New Jersey, Atlantic City Electric, tok say dem dey 'prepare to handle any issues'.
Delaware Electric Coop tok say 'dem dey face serious mess' sake of say 'countless trees, powerlines and utility poles' don fall becos of di snow.

Dis map show di potential impact of di storm ova di next few days, based on di winter storm severity index from di National Oceanic and Atmospheric Administration (NOAA).
Di categories range from moderate (pipo fit expect disruption such as hazardous driving conditions and some closures) due to extreme substantial disruptions, wen disruption hapun, no travels dey advised and "life-saving actions fit dey needed").









