Police for South Africa charge former Zimbabwean president son Bellarmine Mugabe wit attempted murder

Bellarmine Mugabe

Wia dis foto come from, SABC Screengrab

Read am in 3 mins

Di Police for South Africa don arraign Bellarmine Mugabe, di last son of former President of Zimbabwe Robert Mugabe, for court on Monday, sake of allegations of attempted murder and possession of fire arm.

Dem arrest di young Mugabe togeda wit anoda suspect, Tobias Mugabe Matonhodze, afta police bin arrest dem for alleged shooting one 23-year old man wey dey work for dia residence for Hyde Park, Johannesburg.

Di oda accused person dey described as di bodyguard to Bellarmine Mugabe.

Bellarmine Mugabe

Wia dis foto come from, Anadolu Agency via Getty Images

Investigation into di shooting bin dey hampered sake of say di gun wey dem use shoot di boy don vanish mysteriously and police still neva find am, and dis na why di authorities add one more charge - defeating the ends of justice - against di suspects.

Officers bin recover bullet cartridges for di scene of di crime but dem believe say di disappearance of di gun has mean say pipo bin don compromise di crime scene bifor investigators arrive.

Dem arraign di two suspects bifor di Alexandra Magistrate's Court on Monday morning and di court don adjourn until March 3 to rule on dia bail application, meanwhile dem go dey remain for prison custody reach dat time.

Di boy wey shoot still dey for critical condition for hospital.

Dis issue don resurrect memories of 2017 wen Grace Mugabe, di mother of Bellarmine, bin dey accused of assaulting one South African model Gabriella Engels.

Di matter bin escalate dat time and almost cause quarrel between di two kontris, bifor di South African Minister of International Relations dat time, Maite Nkoana-Mashabane grant di Zimbabwe first lady diplomatic immunity.

Howeva, one high court judge later overturn dat decision and order di arrest of Mrs Mugabe; dat arrest order still dey in place and tori be say Grace Mugabe fit dey arrested anytime she enta South Africa again.

Robert Mugabe die for 2019, afta e don lead Zimbabwe for 37 years bifor dem force am out of power for di age of 93 for 2017.