After Biden endorse Kamala Harris what next and wetin e mean for her, di Democrats and Trump?

President Joe Biden and Vice President Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Joe Biden don endorse Kamala Harris, but wetin go happun next no dey straightforward
Read am in 4 mins

President Joe Biden bin surprise American voters on Sunday wen e announce say im no go run for president again.

Dis announcement dey come afta e tackle plenty calls to step down.

Although e go carry out di rest of im presidency, e however don endorse Vice President Kamala Harris to take im place as di Democratic Party nominee.

Di decision don throw put the parties on their toes, as na just one month remain before di Democratic National Convention.

Dis na guide to wetin fit come next.

Wetin go happun now?

Di last time wey something like dis happun na for 1986, wen di den incumbent US president, Lyndon Baines Johnson abandon dia campaign for re-election.

Sake of dat, di process to nominate new candidate so close to Election Day no dey clear.

President Biden don already win 3,896 pledged delegates during Democratic primary contest. Dis number pass di amount wey dey needed to secure im party nomination.

Those delegates bin vote for Biden-Harris ticket previously, but e go dey up to dem to decide which candidate dem wan support as di Democratic nominee during di party convention next month.

While Oga Biden endorsement make Madam Harris di most likely pick for di nominee, e neva dey certain wetin go happun afta e release im delegates.

Open convention fit dey?

Dem schedule di Democratic National Convention to begin on 19 August.

If di Democratic Party no come togeda to support a new candidate, dat fit set di stage for open convention for di first time since 1968.

Dis go mean say delegates go dey free to decide who to vote for among multiple candidates if dem emerge.

Candidates go need signatures from at least 300 delegates - no more dan 50 from one state - for dia name to appear on di ballot.

One initial round of voting go dey among di 3,900 pledged delegates, wey include voters wey pipo believe say dey loyal to di Democratic party.

If no candidate receive majority of votes afta dis first round, den more rounds of voting go take place. Dis rounds of voting go include superdelegates - party leaders and elected officials – all of dem go cast dia ballots until dem choose a nominee.

To secure di party nomination, a candidate go need 1,976 delegate votes.

Who fit challenge Ms Harris?

As calls grow for Oga Biden to drop out of di race in recent weeks, a number of potential replacements don come out.

Dem don fly Michigan Democratic Governor Gretchen Whitmer name as candidate, though she tok say she no dey consider to run if Oga Biden step aside.

On Sunday, minutes afta Oga Biden announcement, she say she go do everything she fit "to elect Democrats and stop Donald Trump".

And some oda rumoured replacements don rally behind Ms Harris – wey include California Governor Gavin Newsom, Transportation Secretary Pete Buttigieg and Pennsylvania Governor Josh Shapiro.

Dem fit consider some of dis candidates for di role of vice president if Ms Harris later win di nomination.

Harris approval rating and wetin Biden step down mean for am, di Democrats and Trump

E dey possible say most Democrats go follow di president lead and fall in line behind di vice-president to avoid any kasala less dan one month from di Democratic convention.

Practical and political reasons dey for doing so.

She be next in di constitutional line of succession. To pass ova di first black woman on a presidential ticket go dey terrible for di party. She go also immediately get access to di roughly $100 million in funds di campaign don raise so far.

But risk also dey. Public opinion surveys show say Harris approval ratings dey low like dat of Oga Biden. And in head-to-head matchups against Donald Trump, she dey di same boat as Biden.

One recent CNN poll bin suggest say she fit do beta dan di president against Trump for November.

For head-to-head contest, Ms Harris follow di Republican by only two points, while Mr Biden dey behind wit six points.

Di poll also suggest say Ms Harris performance beta pass Mr Biden wit independent voters and women.

Di second thing be say, Harris bin one time get rocky time as vice-president. Early on for di administration, dem bin give her di work of addressing di root causes of di migration crisis for di US-Mexico border.

Di task bin dey challenging, and a number of missteps and misstatements bin open her up to criticism.

She also be di administration point pesin on abortion rights, wey be topic wey she don dey handle well-well. But those first impressions still dey pipo mind.

Finally, and perhaps most importantly, Harris bin don already run for national office - her 2020 bid for di Democratic presidential nomination – bin fall flat and e end badly.

Choosing Harris na risk for Democrats, but at dis point, no safe options dey. And di stakes – a possible Donald Trump victory – dey very high.