Joe Biden end re-election campaign, endorse Kamala Harris as Democratic nominee

Joe Biden and Kamala Harris

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

U.S. President Joe Biden don end im re-election campaign, saying "na in di best interest of my party and di kontri".

Dis dey dey come four months bifor Americans go polls to vote for new president, ending im race for di White House.

E dey follow weeks of serious pressure from Biden fellow Democrats afta wetin critics describe as poor performance for di presidential debate wey im do against Republican Donald Trump for end of June.

For letter wey im post for im social media account, im say na great honour of im life to serve as president.

"And while I for like to do re-election, I believe say na in di best interest of my party and di kontri for me to step down and to focus solely on fulfilling di duties as President for di remainder of my term."

President Biden tank im Vice President, Kamala Harris, saying she be "extraordinary partner".

Di president give im support to im vice, Kamala Harris as im say: “Today I wan offer my full support and endorsement for Kamala to be di nominee of our party dis year.”

E no forget to call im party members make dem join hand togeda and beat Donald Trump.

President Biden say im go speak to di nation in more details about im decision later dis week.

Joe Biden

Wia dis foto come from, Getty Images

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

"And make I express my heartfelt appreciation for di American pipo for di faith and trust wey you place in me," im statement add.

"I believe today and wetin I always believe: say e no get anytin wey America no fit do - wen we do am togeda. We just gatz remember say we be di United States of America."

Last week Biden bin return to im house for Delaware afta im bin get Covid, but on Friday im say im dey look forward to "getting back on di campaign trail next week (dis week)".

Im bin dey always tok bifor say only di "Lord Almighty" fit make am withdraw, but later im kon say, im go consider withdrawing if im get health condition.

Clintons endorse Harris

Bill Clinton, di former US president, and im wife Hillary Clinton, wey run against Trump for 2016, don endorse Kamala Harris.

For one statement wey di former president post on im X account, dem say dem go do "whatever dem fit to support her".

"Now na di time to support Kamala Harris and fight wit evriting we get to elect her," dem add.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

We go win - Harris

Vice President Kamala Harris don react to President Joe Biden endorsement of her as Democratic presidential nominee for di November election.

She write: "I go do evritin in my power to unite di Democratic Party—and unite our nation—to defeat Donald Trump and im extreme Project 2025 agenda."

“We get 107 days until election day. Togeda, we go fight. And togeda, we go win.”

She thanks Biden for his "extraordinary leadership" and "decades of service to our country".

Vice President Harris describe President Biden decision to end im re-election bid as "selfless and patriotic act" and add say she dey "honoured" to get Biden endorsement.