King Charles Coronation don happun for Westminster Abbey in di presence of family and guests

King and Queen inside Gold State Coach

Dem don crown Charles III as King inside ceremony wey full of music and symbolism inside Westminster Abbey

Wearing im grandfather crimson velvet robe, King Charles swear oath, dem anoint am with holy oil, before dem place di St Edward Crown ontop im head.

Dem crown Camilla, di Queen Consort, with Queen Mary Crown inside a similar ceremony small time afta.

About 2,200 pipo, including di Royal Family, celebrities, faith leaders and heads of state, bin dey inside di Abbey to witness di event

Di King and Queen Consort, Camilla, bin arrive for di service for di Diamond Jubilee State Coach

Thousands of pipo bin bone di rain to line di route from Buckingham Palace through central London

During di ceremony, di Archbishop of Canterbury acknowledge di multiple faiths observed for UK by saying di Church of England "go seek to foster environment wey pipo of all faiths may live freely".

Guests as dem bin arrive for Westminster Abbey for di coronation

Members of di House of Lords - group of dem, around 20, bin first enter.

Among dem na Lord Mandelson and Baroness Louise Casey, dressed in dia traditional red robes.

Members of di House of Lords arrive King Charles coronation

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Members of di House of Lords arrive King Charles coronation

Oda guests arrive in a mix of morning suits and hats and heels - some dey feem di occasion as dem dey make dia way in, all of dem look very happy.

Oda pipo wear military medals.

US singer Katy Perry, wey go perform for di concert tomorrow, arrive in purple fascinator and pearl Vivienne Westwood choker.

Oda guests like di Mayor of London, Sadiq Khan plus odas don land.

US singer Katy Perry

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US singer Katy Perry dey deep in conversation with British Vogue editor Edward Enninful.
King Charles coronation

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Ukraine First Lady Olena Zelenska
Mayor of London Sadiq Khan

Wia dis foto come from, PA Media

Wetin we call dis foto, Anoda recognisable face - Mayor of London Sadiq Khan.
Nick Cave and Rowan Williams arrive togeda

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Nick Cave and Rowan Williams arrive togeda. Earlier dis week, Cave surprise fans who know am best as a hellraiser by writing of im "inexplicable emotional attachment to di royals"
Guests arrive for King Charles coronation

Wia dis foto come from, PA Media

Guests arrive for King Charles coronation

Wia dis foto come from, Mary Evans Picture Library

Guests arrive for King Charles coronation

Wia dis foto come from, PA Media

King Charles coronation

Wia dis foto come from, Press Eye

Wetin we call dis foto, Singer Lionel Ritchie shares a joke with Mayor of London Sadiq Khan

King on im way to abbey

Dis na di fotos of di King as e bin comot Buckingham Palace to Westminster Abbey.

Carriage wey carry di King and Queen Consort Camilla move into small waiting procession.

Dem receive Royal Salute from di King Guard as dem set off.

King Charles III inside carriage

Wia dis foto come from, Reuters

King Charles III and di Queen Consort inside di carriage

Wia dis foto come from, PA Media

King Charles III dey carriage dey head for di coronation

Wia dis foto come from, Reuters

Britain King Charles and Prince George stand outside Westminster Abbey

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Britain King Charles and Prince George stand outside Westminster Abbey

Prince Edward and Princess Anne arrive

Di Duke and Duchess of Edinburgh arrive for di abbey with dia children - as well as di Princess Royal and Timothy Laurence.

Di Duke and Duchess of Edinburgh arrive for di abbey

Wia dis foto come from, PA Media

Princess Anne arrive for di Abbey

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Princess Anne arrive for di Abbey

Prince Andrew and Princess Eugenie arrive

Di Duke of York and im daughter Princess Eugenie travel inside car before dem enter Westminster Abbey.

Di Duke of York and im daughter Princess Eugenie

Wia dis foto come from, PA Media

Which time everytin go happun today?

Dis na how today events go waka:

09:30 - World leaders and heads of states begin to arrive for di Abbey

10:20 - Di King go do procession leave Buckingham Palace. e go go along di Mall to Trafalgar Square, den down Whitehall and Parliament Street before turning into Parliament Square and Broad Sanctuary.

Di King and Queen Consort go ride in di Diamond Jubilee State Coach. Di route go dey surrounded by 1,000 members of di military.

11:00 - Di ceremony go begin. E go dey marked with music selected by di King, with 12 newly commissioned pieces, including one by Andrew Lloyd Webber.

Di King grandson, Prince George, go dey among di pages, alongside Camilla grandchildren, Lola, Eliza, Gus, Louis and Freddy.

12:01 - Dem go crown di King.

13:00 - Di King and Queen go den return to Buckingham Palace along di reverse of di route wey dem take come, dis time, travelling in di 260-year-old Gold State Coach wey dem don use for every coronation since William IV.

Just before 14:30 - King Charles and Queen Camilla go greet di crowds for Di Mall from di Buckingham Palace balcony. Dem neva confam yet which oda members of di Royal Family go dey involve.

Those wey dey dia go witness di end of di day public celebrations, with a six-minute fly-past plan involving members of di Army, Royal Navy and Royal Air Force and ending in a display by di Red Arrows.