Al Jazeera reporter shot dead: Shireen Abu Aqla die during Israeli raid for West Bank

Wia dis foto come from, Reuters
Bullet don hit and kill Al Jazeera journalist Shireen Abu Aqla while e dey report on one raid by Israeli security forces for di occupied West Bank city of Jenin.
Di Qatar-based news channel dey accuse Israeli troops say dem "deliberately" shoot and kill Abu Aqleh, wey be 51 years old and "in cold blood." Dem also shot and wound anoda reporter.
Di Israeli military deny say dia forces target journalists.
Dem dey look into "di possibility" say e fit be say na bullet "from Palestinian gunmen hit dem" during one exchange of fire.
Israel Foreign Minister Yair Lapid describe Abu Aqla death as "sad" and tok say dem don offer to carry out one joint investigation with di Palestinian Authority.
"Journalists must dey protected in conflict zones and we all get responsibility to get to di truth," e add.
Qatar Assistant Foreign Minister Lolwah al-Khater tok say dem shot Abu Aqla "for face" wen she bin wear press flak jacket and helmet.

Wia dis foto come from, Al Jazeera
Di Palestinian health ministry confam Abu Aqla death and say dem bin rush am go hospital in critical condition afta bullet touch am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Shireen Abu Aqla na pesin wey pipo sabi well-well on Al Jazeera Arabic news service - she don dey cover di Israeli-Palestinian conflict for 15 years.
Al Jazeera journalist Nida Ibrahim tok say she be "very well respected journalist" and say di news na "shock to di journalists wey don dey work with her."
Plenti of attacks by Israeli Arabs and Palestinians inside Israel for recent weeks don cause di death of l 17 Israelis and two Ukrainians.
At least 26 Palestinians don die - including attackers wey dem shoot die as dem dey carry out attacks, or militants and civilians wey die during Israeli raids and gbege for di West Bank.
Israeli operations bin dey centred on di Jenin district, wia four of di Palestinians wey carry out attacks for Israel come from.










