Sudan military return Abdalla Hamdok as Prime Minister afta October coup

Wia dis foto come from, Reuters
Sudan Prime Minister Abdalla Hamdok wey dem bin comot through coup last month and put under house arrest don return back to power.
E show ontop TV to sign one new power-sharing agreement with coup leader Gen Abdel Fattah al-Burhan even as mass protests dey continue.
But di civilian coalition wey bin nominate Mr Hamdok as PM two years ago don refuse to reason any new deal.
Di agreement hapun with a gun to im head, one tok-tok pesin tell BBC.
"Di future of di kontri go dey determined by di young pipo on di ground," Siddiq Abu-Fawwaz, from di Forces for Freedom and Change (FFC) coalition, tell BBC Newshour programme.

Wia dis foto come from, Getty Images
On di streets of di capital, Khartoum, security forces don fire tear gas give protesters wey dey march towards di presidential palace and dem dey demand make di military completely withdraw from politics.
Since 25 October, wen di military declare a state of emergency and dissolve di civilian leadership, at least 40 pipo don die for inside mass protests against di coup.
Dis agreement establish cabinet of technocrats and allow for di release of political prisoners.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Hamdok dey quoted as saying im agree to di deal to stop further bloodshed.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Leader of Sudan Umma Party, Fadlallah Burma Nasir say dem bin reach di deal late for night on Saturday.
Di group of mediators wey include academics, journalists and politicians release statement about wetin di agreement tok.
Di new deal go see Hamdok cabinet ministers wey dem bin arrest dey released.
E also say, di rules for Sudan to move to democracy go remain di same.
Kasala dey between Sudan military and civilian goment on how dem go take share power since dem pursue long term president Omar al-Basir from power for 2019.
Di coup wey happun for Sudan on October 25, 2021, wia di prime minister and im cabinet chop arrest and goment dey dissolved na di latest crisis di kontri dey witness.

Wia dis foto come from, Reuters
Tension wey bin dey between Sudan military and political leaders
Before di October 25 Coup, military leaders for di transitional goment dey demand for reforms from dia civilian counterparts and want make dem replace cabinet.
But civilian leaders ignore am, as dem see am as power grab.
Plenty failed coups don dey since 2019, di most recent na that of September 2021.
Prime Minister Abdallah Hamdok, blame Bashir loyalists - many of dem dey di military, security services and oda state institutions.
In recent weeks, many pipo wey support di army enta street to protest for di kontri capital, Khartoum.
Afta di October military take over, di group wey also dey back di prime minister also do counter-protests.
Di protesters wey dey support di military accuse goment say dem fail to revive di kontri fortunes.
Oga Hamdok moves to reform di economy - wey include reducing fuel subsidies - na something wey evribodi no flow wit.
Sudan political weakness get long history of tins wey don happun before now.
Before now, di political parties wey don split and dia failure to build consensus give way for di military to step in, mount coups under pretense say dem go restore order - as regional analyst Magdi Abdelhadi write.
Today for Sudan, at least 80 political parties na im dey.
Dis same factionalism disturb di Sovereign Council, wia internal divisions among both di military and civilian camps push political consensus yet further out of reach.












