Mmesoma Ejikeme: Candidate wey Jamb accuse of falsifying her score speak out, Anambra government reaction

Anambra state goment and JAMB logo

Wia dis foto come from, Twitter

Read am in 4 mins

Di candidate wey Jamb sama accuse give don reject accusation say she inflate her exam score.

A video of her wey don go viral on social media show wia she tok her own side of di story.

For di video di candidate say she no dey capable of forging result and she dey traumatized wit di board claim.

Di video show di young girl wey hold her result dey explain wetin happun.

"I be di owner of dis results, I go Jamb portal go print dis result and dis na wetin dem give me.

"Dis na my aggregate - 362, dis na exactly how I print out di result from di site.

"Jamb saying I forge result na wetin I know no. Dem say I forge my result, Dem scan dis QR code and e show anoda name and she score 138 but dem later change am say she score 318 wey show say problem dey some wia."

DSS involvement, oda tins di Jamb candidate tok

Di candidate explain say she and her school principal carry di result and the SMS Jamb send to her go show di Commissioner for Education for dia state.

Di commissioner scan am and send to JAMB to verify.

But Jamb call her back and tell her say di result na fake and say she forge di result and dem call di Nigeria Secret Police, DSS to come carry dem from di Commissioner office.

"Di DSS carry us go dia office, we write our statement there and dem say dem go investigate di result but instead make Jamb wait for di outcome of di investigation, dem post say I forge my result without confirmation." She tok.

Anambra state goment for South-east Nigeria don set up panel of inquiry to torchlight di controversy wey surround di case of di highest scorer for di 2023 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME).

Dis na step wey di goment take sake of di plenty controversy wey concern di issue of who get di highest score for di 2023 UTME wey Jamb do.

Prof Ngozi Chuma-Udeh, di state Commissioner for Education wey give dis informate tok say goment regret di development and e dey very embarrassing.

She say di matter dey happun for di time wen di Governor Charles Soludo led administration dey try get education right for di state.

Di Prof add say security agents dey investigate di allegation of fake result wey di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) sama against di candidate wey allegedly change her score.

Di state goment bin celebrate one student of Anglican Girls Secondary School Uruagu for Nnewi, wey her tori go viral afta she announce say she score 362 - di highest score for di 2023 UTME.

Plenty pipo hail her and she even get scholarship from one ogbonge Nigerian business entrepreneur, Chief Innocent Chukwuemeka wey be di owner of Innoson Motors.

E no tey before di Nigeria examination joinbody, di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) burst her bubble as dem claim say di result na fake.

JAMB on Sunday tok say dem discover say some students dey use some kain mago-mago way to change dia results.

Di Board say di students change dia score from di original result wey dem get for di exam.

Di most pathetic of dem all na one case wey di candidate claim to don score 362 for di 2023 UTME, Jamb tok for one statement dem release on Sunday.

Jamb say di candidate allegedly use her inflated result collect scholarship from one business man wey worth three million naira ($2000).

Wetin Anambra state goment tok

Anambra state goment say dem go set up panel to chook eye into di controversy wey surround di case.

For inside statement from di Ministry of Education wey di tok-tok pesin Nnaemeka Egwuonwu issue, say security agents dey investigate di accused of fake result levelled against di student, wey social media bin carry say na she get di highest score for di exams.

Di statement add say meanwhile, goment go kontinu to celebrate celebrate Nkechinyere Umeh, wey Jamb declare say na she get di highest score wit a cumulative mark of 360 for di 2023 UTME,

Celebrated candidate use magomago increase im score - JAMB

Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) bin tok say one candidate, Ejikeme Mmesoma (Joy) wey pipo bin earlier celebrate say get di highest mark for di 2023 Unified Tertiary Matriculation Examinations (UTME) bin falsify her result.

According to JAMB, di candidate actual score for di test na 249, no be di 362 wey she claim say she score.

Jamb say dem discover di mago-mago wen officials of di Anambra state goment call dem to verify weda true-true one of di candidates get di score wey e claim. Di Anambra goment bin dey plan to also honour am.

"Na dat time di board reveal say di candidate original score na 249 and not di 362 e claim.

"E bin don manipulate im UTME result to deceive di public to fraudulently and obtain scholarships and oda recognitions."

Jamb say dis follow for wetin make dem discover anoda fraudulent candidate for Kaduna wey claim to don score a 380 aggregate score for di last UTME.

"Im ethnic group bin even take up di issue, requesting make we give am special recognition, only for di board to disappoint dem wit di incontestable fact say Atung no even buy di 2023 Jamb form, not to talk of sitting di examination."

Innoson Motors react to controversy

Innoson Vehicles Manufacturing (IVM) company tok say dem go withdraw di scholarship dem give di candidate if dem discover say true-true she fake her UTME result.

Di company Head Corporate Communications, Cornel Osigwe for im Twitter account tok say dem go carry out dia own independent investigation on di issue of manipulation of result.

If dem discover say di candidate manipulate her result, dem go withdraw di scholarship but if dem observe say she dey innocent of di accuse, den "di scholarship stands, weda she be di best or not."

Innoson Vehicles bin promise her three million naira scholarship sake of her achievement.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Who be di highest 2023 UTME scorer?

According to di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), di overall best student for di 2023 UTME na Umeh Nkechinyere wit registration number 202330325356GA.

Nkechineye na indigene of Anambra state and she score 360 points.

Anambra state goment say dem go celebrate Nkechinyere Umeh afta JAMB declare her as di highest scorer.