Reactions afta Jamb say celebrated candidate use mago-mago increase im score

Jamb logo

Wia dis foto come from, Jamb/Web

Reactions dey come in afta Nigeria exam joinbodi di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) express dia disappointment in some students wey take di 2023 exam.

Jamb say dem discover say some students dey use some kain mago-mago way to change dia results.

Di Board say di students change dia score from di original result wey dem get for di exam.

Di most pathetic of dem all na one case wey di candidate claim to don score 362 for di 2023 UTME, Jamb tok for one statement dem release on Sunday.

Jamb say di candidate allegedly use her inflated result collect scholarship from one business man wey worth three million naira ($2000).

Fabian Benjamin, tok-tok pesin for Jamb say di Board go take serious actions against di students.

Di N3million scholarship to one of di candiodate na from Chief Innocent Chukwuma, wey get Innoson motors, di board tok.

But for one post for im Twitter handle, Head Corporate Communications

IVM Innoson Group say e no believe say di candidate do dat kain tin.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Jamb tok how di students allegedly increase dia scores

Na on Sunday Jamb bring out statement say one candidate score 249 for di April 2023 nationwide exam. But she "manually increase her score to 362", di statement tok.

Di board say dem dey disappointed say she and oda students do dat kain tin wey no make sense.

Dem also say di students use di inflated score get popularity for social media wey make pipo offer dem scholarship.

Oga Benjamin say dem use some kain software to change dia results.

“Di attention of di Joint Admissions and Matriculation Board dey drawn to several publications in both print and online media celebrating certain candidates for being high scorers in di 2023 UTME.

“Di Board dey constrained to set di records straight and wish to tok tins as dem be and dat na say many of results wey many of these candidates dey carry upandan na fake.

"In many occasions some of these candidates bin get far lower scores dan dem dey claim.

"Dem use some funny software packages to manipulate dia results to deceive unsuspecting members of di public," Jamb tok.

Jamb say dem discover di mago-mago wen officials of di Anambra state goment call dem to verify weda true-true one of di candidates get di score wey e claim. Di Anambra goment bin dey plan to also honour am.

"Na dat time di board reveal say di candidate original score na 249 and not di 362 e claim.

"E bin don manipulate im UTME result to deceive di public to fraudulently and obtain scholarships and oda recognitions.”

Jamb say dis follow for wetin make dem discover anoda fraudulent candidate for Kaduna wey claim to don score a 380 aggregate score for di last UTME.

"Im ethnic group bin even take up di issue, requesting make we give am special recognition, only for di board to disappoint dem wit di incontestable fact say Atung no even buy di 2023 Jamb form, not to talk of sitting di examination."

Wetin next for di candidates?

Jamb say di students must face punishment.

Jamb note say dem go withdraw di candidate result and also prosecute am.

"Dis no be all, as di board go in due course, investigate all candidates wey dey lie say dem get higher scores dan dem actually get."

Once discovered, Jamb say dem go "withdraw all dia results and hand dem to security agencies for prosecution.”

Di Nigeria exam joinbodi beg Innoson Motors and oda well-meaning Nigerians make dem no vex.

Dem say make pipo dey try verify results of students from exam boards before granting scholarships or financial help.