Dangote Petroleum Refinery: Location, capacity and oda tins you need know about Dangote oil refinery

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Dem don open Africa biggest oil refinery for Nigeria, wit hope say e go alleviate chronic fuel shortage.
Nigeria na major oil producer but dem dey send most of di oil abroad and import di refined fuel dem dey use inside vehicles and elsewia.
Sake of dis, di kontri dey most times dey face chronic fuel shortages.
Dis na di problem wey di $19bn (£15.2bn) refinery, owned by Africa richest man, Aliko Dangote, wan tackle.
Di plant, wey neva dey operational, get di capacity to produce about 650,000 barrels of petroleum products per day - more than enough to supply di needs of di kontri. E also include one power station, deep seaport and fertiliser plant.
CEO Dangote Group and Petrochemicals Sanjay Gupta say di plant na di "di largest single-train refinery in di world."
Some experts too don already say di facility no doubt go create more employment opportunities for Nigeria large population.
Di refinery go produce Premium Motor Spirit (PMS), diesel (AGO), aviation jet fuel and Dual-Purpose Kerosene (DPK), among oda refined products.
End of Di one wey oda users dey read well well
But wetin else you need to know about am?

Wia dis foto come from, Dangote Refinery
Some facts about di Dangote refinery
- Di refinery dey for Ibeju-Lekki area of Lagos and e cover a land area of approximately 2,635 hectares.
- According to di Dangote Group, di facility go be di world largest Single-Train 650,000 barrels per day Petroleum Refinery with 900 KTPA Polypropylene plant.
- At full capacity, e dey expected to meet 100% of Nigeria requirement of all refined products and e go get surplus for export
- E dey designed to process large variety of crudes including many of African Crudes, some of di Middle Eastern Crudes and di US Light Tight Oil.
- E get 177 tanks of 4.742 billion litres capacity
- According to statement from Dangote, dem use di world largest dredgers to dredge 65 million cubic metrs of sand and e cost approximately €300 million.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
For March 2022, President Buhari bin also journey go Lagos go cut tape to open Dangote Fertilizer Plant.
Tori also be say di Dangote Groups Fertilizer Plant, dey expected to function as di world biggest fertilizer plant.
Di plant wey get capacity of three million tons a year of urea and ammonia also dey for Lekki district of Lagos.
'Game changer for Nigeria economy' - Buhari
President Muhammadu Buhari on Monday wen im dey inaugurate di Dangote Petroleum Refinery for Ibeju-Lekki, Lagos, say dis go be ogbonge milestone for Nigeria economy and go be game changer for di downstream petroleum products market for di entire African region.
''Dis mega industry we dey commission today na clear example of wetin we fit achieve if we encourage and support entrepreneurs and create enabling environment for investments and for businesses to thrive.", e tok.
Di Heads of State from Ghana, Togo, Niger, Senegal and one representative of di President of Chad attend di inauguration wia Oga Buhari also stree di need for African kontris to come togeda, integrate dia economies and eliminate trade barriers.
For di launch, Oga Dangote also outline im hopes for di refinery say: "Our first goal na to ramp up production of di various products to make sure say within dis year, we go fit fully satisfy di kontris demand for quality products."
Meanwhile, e neva dey clear wetin go be di impact of di plant on di price of fuel for di kontri wia dem dey subsidise retail prices.
Di goment say dem go remove dis subsidies - wey last year take up nearly one third of di national budget.
E also no dey clear how di refinery go get im oil as e no get any pipeline wey dey connect am to Nigeria oil fields: "I' dey assume say dem go use ships and barges to supply crude to di refinery," oil and gas expert Henry Adigun tell BBC.












