Arsenal vs Bournemouth: Gunners show class as dem use Di Cherries clean floor for di Premier League

William Saliba

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, William Saliba as e dey celebrate Arsenal third goal

Na sweet day for Arsenal fans as di Gunners knock dia rivals, Bournemouth 3-0 for di Premier League.

Martin Odegaard score di first two goals for di first half within 10 minutes wey give Arsenal good lead.

Di Gunners also show good ball possession as dem dominate di game.

Afta 90 minutes, and di win, Mikel Arteta team still tanda gidigba for di league table.

Di match happun for Vitality Stadium for Dorset, England.

Arsenal Line-up

Arsenal XI: Ramsdale, White, Partey, Gabriel, Saka, Odegaard, Jesus, Martinelli, Saliba, Xhaka, Zinchenko.

Subs: Turner, Tierney, Smith Rowe, Nketiah, Holding, Tomiyasu, Vieira, Sambi Lokonga, Elneny.

Bournemouth line-up

Bournemouth XI: Travers, Kelly, Mepham, Lerma, Smith, Tavernier, Moore, Pearson, Senesi, Billing, Zemura.

Subs: Murara Neto, Cook, Christie, Marcondes, Stacey, Lowe, Dembele, Hill, Anthony.

Presentational grey line

Live update as di match dey happun

FIRST HALF

Game don start!

Bournemouth 0-0 Arsenal

5mins: New captain Martin Odegaard score first goal for Arsenal.

Dis one come afta stunning football from di visitors, Gabriel Jesus trap high ball, turn im man before slipping Gabriel Martinelli in on goal.

Di Brazilian set imself and see im low drive saved by Mark Travers but di Norwegian bin dey in di right place for di easiest of finishes.

  • Bournemouth 0-1 Arsenal

9 mins: Arsenal well on top for di early exchanges wit a goal to show for am.

Dem dey flood forward at every attack.

10mins: And di goals don turn two for Arsenal. and na from Martin Odegaard again.

  • Bournemouth 0-2 Arsenal

14 mins: Arsenal be like dem dey in di mood, dem dey hungry for more goals and at di moment na case of how many dem go get.Some football facts: Martin Odegaard na di third Arsenal player to score twice for di first 11 minutes of any Premier League match, afta Kanu for October 2002 v Sunderland and Eddie Nketiah v Leeds for May.

18mins: Scott Parker, dey stand on di touchline, dey furiously chomp on chewing gum, as e dress in his now trademark grey cardigan wit di stripes. £900 dey expensive,

Bournemouth v Arsenal premier league

Wia dis foto come from, Getty Images

21 mins: Arsenal for dia salmon coloured kits dey leap to di top of di Premier League table wit three wins from three, as e stand.

Wit 73% possession so far and dem dey threaten to run riot on di south coast.

27 mins: Martin Odegaard, on a hat-trick target, decide to clip am to di back post for Granit Xhaka but e don get too much for am and di Swiss midfielder no fit retrieve di situation.

29 mins: Gabriel Martinelli, get a pass from Bukayo Saka on di edge of di box but di Brazlian dey crowded out and im no fit get di shot away.

30mins: Half an hour gone, Arsenal dey in total control.

34 mins: Ben White dey play as a right-back wit Takehiro Tomiyasu on di bench afta injury.

39mins: Ben White bin don dey bomb down di right all game and dis time put in a low cross right across di six yard box.

So far, Bournemouth 0-2 Arsenal

44 mins: Bournemouth striker Kieffer Moore get bloodied nose afta Gabriel hand hit am for face.

HALF-TIME

Bournemouth 0-2 Arsenal

One first-half double from Martin Odegaard leave Arsenal in charge for di break.

Presentational grey line

SECOND HALF

Game don start.

Changes for Bournemouth for di start of di second half.

Lewis Cook and ex-Arsenal academy product Jaidon Anthony come on. Ben Pearson and Marcos Senesi make way.

48 mins: Jefferson Lerma meet one cross at di far post and send am back towards goal, but Gabriel attempt clearance loops high into di air and Aaron Ramsdale gather am.

Bournemouth don already do more in dis half than di entire first 45 minutes.

52 mins: Yellow Card -2 points for Gabriel Jesus, into di book for dragging back Lewis Cook.

Na yellow card for Gabriel Jesus

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Na yellow card for Gabriel Jesus

53 mins: GOAL! - Bournemouth 0-3 Arsenal. William Saliba score for Arsenal

Arsenal finally get dia third of di game and e come courtesy of one stunning strike by French defender William Saliba.

Im get di pass from Granit Xhaka for di edge of di box before im coolly caress a first-time strike across di face of goal and into di far corner of di net.

56 mins: Bournemouth come close to pulling one goal back Gabriel clear off Marcus Tavernier dangerous corner.

60 mins: Bournemouth defender Adam Smith gbab yellow card for a hack on one Arsenal man.

  • Bournemouth 0-3 Arsenal

64 mins: Substitution Ryan Christie coming on for Bournemouth. Afta some confusion, na Philip Billing make way.

71 mins: Gabriel Jesus don score di fourth goal for Arsenal.

Bournemouth 0-4 Arsenal.

72 mins: Disallowed goal, referee flag Gabriel Jesus goal as offside.

As e be na Bournemouth 0-3 Arsenal.

73 mins: Triple sub for Arsenal - Eddie Nketiah, Emile Smith Rowe and Takehiro Tomiyasu enta di action.

Martin Odegaard, Gabriel Martinelli and Ben White make way.

79 mins: Arsenal goalkeeper save di day for im team as im dive high to im left to tip away Kieffer Moore looping header.

83 mins: Aaron Ramsdale preserve im clean sheet here, as im gada one shot at di near post from Jordan Zemura.

84 mins: Free kick for Bournemouth

85 mins: Na Marcus Tavernier step up...and ripple di net! on di wrong side. Na close goal.

86 mins: Gabriel Jesus in on goal but shoot straight at Mark Travers. Im dey offside anyway.

87 mins: Final two changes for Arsenal

Albert Sambi Lokonga and Kieran Tierney make way for Granit Xhaka and Bukayo Saka.

89 mins: Close shot for Eddie Nketiah

90+2 mins: Bournemouth 0-3 Arsenal

FULL-TIME

Bournemouth 0-3 Arsenal

Na straight forward victory for di mightily impressive Arsenal side, as dem go top of di table