Anthony Joshua vs Oleksandr Usyk 2 fight - Wetin you need know

Anthony Joshua

Wia dis foto come from, Getty Images

Anthony Joshua and Oleksandr Usyk go face each oda again dis weekend.

Di two boxers bin fight for September last year, Usyk beat di British-Nigerian boxer on points.

Dat fight happun for London and di victory give di Ukraine boxer Joshua IBF, WBA, WBO, and IBO heavyweight titles

Now Joshua dey challenge Usyk for di belts for Jeddah as im hope to bounce back from im second defeat for im professional career.

If Joshua win e go become di heavyweight champion of di world again.

Dis na all you need know about di ogbonge boxing fight.

Wetin Joshua tok about di fight?

Anthony Joshua vs Oleksandr Usyk 2: Fight date, location, time, how to watch

Wia dis foto come from, Getty Images

Joshua wey be 32 years no too ginger for di press conference, but im say im intend to "get di job done" dis time around.

"That's it, na must win. I like di pressure," Joshua add.

"I want to compete. I dey look forward to am. I no fit really tok too much. You gatz get competitive spirit. I dey look forward to am."

Wetin Usyk tok about di fight?

Anthony Joshua vs Oleksandr Usyk 2: Fight date, location, time, how to watch

Wia dis foto come from, Getty Images

Usyk moral high well-well for di press conference, e wear traditional Ukraine cloth come.

E say: "We learn [about] each oda for di first fight. Him learn [about] me, I learn [about] him.

"... We get enough time to study each oda. Saturday night go be great, great fight."

Di defending champion sing one Ukrainian folk song, wey don dey popular now by those wey dey promote independence and peace for Ukraine since Russia invasion start.

When be Anthony Joshua vs Oleksandr Usyk 2 fight?

Di second fight between Anthony Joshua and Oleksandr Usyk go happun for August 20.

E go begin from 6pm West African Time and di main event ring walk dey expected to start from 9pm.

Wia Joshua vs Usyk rematch dey take place?

Di fight go happun for King Abdullah Sports City Arena in Jeddah, Saudi Arabia.

Dis na Joshua second fight for Saudi Arabia and im go dey hope for di same result as last time.

For December 2019, e beat Andy Ruiz for dia afta im surprise defeat to di Mexican earlier dat year.

Meanwhile dis na di first time Usyk dey fight for Saudi and im go dey hope to keep im perfect professional record.

How to watch Anthony Joshua vs Oleksandr for Nigeria?

For now no cable station dey carry di Joshua vs Usyk fight live for Nigeria.

But e fit show abroad for Sky Sport and DAZN.