Champions League quarter-final draw: Chelsea vs Real Madrid, Man City vs Atletico Madrid, Benfica vs Liverpool, Villareal vs Bayern Munich make up quarter-final draw

Wia dis foto come from, UEFA
Di draws for di quarter-finals for di Champions League don take place on Friday, 18 March.
Holders Chelsea go meet Real Madrid for di quarter finals of di Champions League.
Man City go play Atletico Madrid, while Liverpool go meet Benfica and Bayern Munich go jam Villareal
Di semi final pairing go see winner of Manchester City vs Atletico Madrid play winner of Chelsea vs Real Madrid.
While winner of Benfica vs Liverpool go meet winner of Villareal vs Bayern Munich for di semi-final.
Di first team drawn for each fixture go play their home match first, di first legs go hold on 5 and 6 April before di second legs on 12 and 13 April.
Di first leg of di semi-finals go take place on 26 and 27 April and di second legs on 3 and 4 May.
Stade de France for Paris go host di final on Saturday, 28 May after dem move am from St Petersburg after Russia invasion of Ukraine.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Quarter-final fixtures
Chelsea vs Real Madrid
Manchester City vs Atletico Madrid
Villareal vs Bayern Munich
Benfica vs Liverpool
Semi-final draw
Manchester City or Atletico Madrid v Chelsea or Real Madrid
Benfica or Liverpool v Villarreal or Bayern Munich












