Arsenal vs Liverpool highlights: The Reds beat The Gunners 2-0 for Emirates

Wia dis foto come from, Getty Images
Liverpool beat Arsenal 2-0 for Emirates to close di ga between dem and league leaders Manchester City on Wednesday. get di chance to close di gap between dem and Chelsea for dia Premier league match on Wednesday.
Arsenal bin dey also try close di gap between dem and Chelsea but e no happun.
Arsenal bin dey hope to win six consecutive Premier League games for di first time since a run of seven under Unai Emery for 2018.
Mikel Arteta team bin try to get dia fourth consecutive home victory for di league.
Meanwhile, Liverpool now don win nine Premier League games in a row for di first time since dia run of 18 end for February 2020
How di match go
KICK-OFF
FIRST HALF
Game don start for Emirates stadium.
End of Di one wey oda users dey read well well
5 min:
Early corner for Liverpool, na Andy Robertson win am.
Granit Xhaka deflect Joel Matip header behind to concede anoda corner. On di next one, Virgil van Dijk put one dangerous header toward di bottom right corner.
Bukayo Saka try to get away on di right but Andy Robertson slide in to win am.
Martin Odegaard come across to put am under pressure but e give away free-kick.
Sadio Mane win free-kick in di middle. E try to take am quickly but di referee want make e go back as di ball bin still dey roll.
10 mins: Aaron Ramsdale come out of im box to clear one long ball wey Sadio Mane bin de chase.
E go straight to Fabinho, wey tirn am around through Virgil van Dijk.
Cedric Soares catch am for air and Arsenal get space to break. Dem go down di right as Thomas Partey play one nice ball through to Bukayo Saka.
E curl am in and Gabriel Martinelli follow am up for di back post. Na tough one and e get to hit am on di volley. E enta di six-yard area and Joel Matip fit clear am.
Joel Matip ping am over di top for Luis Diaz to run am but e roll through to Aaron Ramsdale.
Trent Alexander-Arnold hold di ball but Kieran Tierney dey dia ahead of Sadio Mane. Di Liverpool forward press am but e deflect straight out for a goal kick.
Gabriel drill am over to Gabriel Martinelli. E flick am and e dey go on di left. E drill am enta middle, Joel Matip leave am and Andy Robertson hook am away a few yards out from im own goal. Dangerous!
15 mins: Luis Diaz face Cedric Soares on di left as di ball dey played through to Andy Robertson. Di Arsenal defender come out on top and take di throw-in.
Trent Alexander-Arnold whip am in from di right as Sadio Mane wait for am in di middle but Kieran Tierney cut am out.
Good defending from Gabriel Martinelli. E sprint back to beat Trent Alexander-Arnold to Jordan Henderson pass.
E come meet Cedric Soares for di middle. E get space to shoot but e dey a long way out. E drag di shot wide and Alisson watch am as e roll by.
20 mins: Liverpool dey in possession again. Thomas Partey half-clear am give Fabinho. Anoda cross come in from di visitors, e head back to Joel Matip but e pass am straight out for a goal kick.
25 mins: Martin Odegaard try to find Alexandre Lacazette but Fabinho stop am.
30 mins: Joel Matip get one important touch on di ball. E come over to di left with Alexandre Lacazette before Granit Xhaka curl am over di bar.
Arsenal dey step tins up now. Ben White play am long for Bukayo Saka and Andy Robertson bin need to get di header right and e do am.
35 mins: Jurgen Klopp vex say Sadio Mane no get free-kick from Cedric Soares for di middle and e still dey hala give di fourth official.
Im side na im get di possession meanwhile, as Luis Diaz challenge Kieran Tierney to a foot race... But di Arsenal full-back win am.
Bukayo Saka try to attack Andy Robertson a few moments later but e go for a goal kick.
Diogo Jota find Luis Diaz. E flick am past di defender to get space on di right but hold am up for support and dem send am back across di middle with Thiago.
40 mins: Trent Alexander-Arnold curl one dangerous ball in for Diogo Jota near post but Arsenal am.
E almost come through to Sadio Mane later but Bukayo Saka defend am.
Liverpool win a corner on di left. Gabriel clear am give Thiago. E send am back in but Aaron Ramsdale stop am.
Trent Alexander-Arnold dey look for Sadio Mane... Good header from Ben White.
Kieran Tierney try to pick out Bukayo Saka but dem clear am. Arsenal dey finish di half strongly but want sometin to show for am.
Jurgen Klopp no happy wit im side performance so far.
45 mins: Sadio Mane control one ball well. E shoot but Gabriel put am under pressure and e go over di bar.

Wia dis foto come from, Getty Images
HALF TIME
Arsenal 0-0 Liverpool
SECOND HALF
45 mins: Match don start again for Emirates.
DISALLOWED GOAL
Jordan Henderson slide am through to Sadio Mane, e dey through on goal and e place am past Aaron Ramsdale but dem rule am out straight away for offside.
Trent Alexander-Arnold send am over di top for Diogo Jota. Ben White block am off and Arsenal win a free-kick.
Gabriel Martinelli trick im way past one, two, three on di left and pull am back into di six-yard area.
Nobody pick am and Liverpool clear am.
50 mins: Thiago give am straight to Alexandre Lacazette. E give am to Martin Odegaard and Alisson get to recover to deflect am over di crossbar!
From di corner, Lacazette ping am give Alisson, wey gada am.
Roberto Firmino and Mohamed Salah dey get ready to come in for Liverpool...
Kieran Tierney to Martin Odegaard... Luis Diaz dey back to defend.
GOAL!
Arsenal 0 - 1 Liverpool
Diogo Jota dey away on di left, di angle dey tight and Aaron Ramsdale suppose do better.
Jota drill am in through di keeper and e enta from di far corner.
55 mins; SUBSTITUTIONS
Mohamed Salah and Roberto Firmino dey on. Luis Diaz and Jota go out.
Granit Xhaka wait for di ball to land for im feet and Joel Matip come in a bit too sharply from behind.
Free-kick to Arsenal. Dem take am quickly but Gabriel Martinelli pass to Alexandre Lacazette dey JUST too heavy. E supose enta!
60 mins; Liverpool get corner on di left and e dey cleared to Mohamed Salah for di edge of di box. E rush di shot as e bring am down den e sky am over.
Gabriel Martinelli touch di ball wen dem ping am over to am on di left E flick am past Trent Alexander-Arnold and e dey gett ready to shoot before di flag go up for offside.
65 MINS;
GOAL!
Firmino get am on di byline a few moments earlier and im cut-back for Mo Salah dey blocked.
Liverpool keep am alive though on di far side with Andy Robertson, wey cut am back and Firmino get dia first to play am into di far corner.
Firminho collect yellow for im goal celebration.

Wia dis foto come from, Getty Images
70 mins: Fabinho flick am through to Sadio Mane. E almost beat Cedric Soares on di left but di full-back recover well.
Mohamed Salah cut inside of Kieran Tierney and curl am it into di box but nobody dey dia and dem allow am to fly out for a goal kick.
SUBSTITUTION
Emile Smith Rowe dey on for Martin Odegaard.
Roberto Firmino clear am up for Liverpool for di left-back position and send am forward for Sadio Mane to chase but Ben White dey dia.
Emile Smith Rowe slip am through to Bukayo Saka on di right. E cut am back for Alexandre Lacazette but Virgil van Dijk get dia before am.
Alexandre Lacazette win am inside di Liverpool half. E find Gabriel Martinelli, who try to cut inside of Joel Matip but di Liverpool defender stand strong.
Joel Matip drive through down di middle, e pass some few challenges before e allow Roberto Firmino to take over.
E eventually lose out to Thomas Partey on di edge of di box.
75 mins: Thomas Partey pick out Gabriel Martinelli on di left. E try to get around Trent Alexander-Arnold but e show am towards di byline, wit help from Joel Matip and Martinelli only fit run am out of play.
SUBSTITUTION
Nicolas Pepe dey on for Arsenal. E replace Bukayo Saka.
Granit Xhaka link up with Cedric Soares. Offside for Nicolas Pepe but di whistle blow afta Fabinho and Jordan Henderson try to clear am togeda and dem end up wit somehow kicking each oda.
Liverpool get corner on di right. Trent Alexander-Arnold curl am in deep but Virgil van Dijk only fit head am into di ground before Gabriel clear am.
Arsenal send am long for Alexandre Lacazette but Thiago reach dia first.
80 mins: Thiago play in Mohamed Salah for di box. E try to squeeze a shot past Gabriel but e no fit..
Andy Robertson come put am in but e dey out for a goal kick.
SUBSTITUTION
Alexandre Lacazette dey replaced by Eddie Nketiah.
Nicolas Pepe want free-kick on di right wey e no get. Thomas Partey go down too but dem get advantage until Pepe win a throw-in.
85 mins: Andy Robertson withstand some few challenges before e cut inside but im pass over to Roberto Firmino go straight to Kieran Tierney.
Kieran Tierney send am forward. Eddie Nketiah dey challenged by Joel Matip.
CLOSE!
Cedric Soares put one free-kick in from di right for Arsenal but Virgil van Dijk head am clear under little challenge.
Emile Smith Rowe get am back for Arsenal. Granit Xhaka find Gabriel Martinelli and e curl am in small past di far post. Alisson was beaten!
90 mins + added time : SUBSTITUTION
Thiago dey off. On comes Curtis Jones dey on Liverpool.
Roberto Firmino steal am from Thomas Partey in di middle but Liverpool no fit capitalise as Sadio Mane dey stopped by Granit Xhaka.
Nice play from Liverpool to bring am out from di back with Jordan Henderson. Roberto Firmino and Mohamed Salah den link-up but di Egyptian pass dey behind Sadio Mane.
FULL TIME
Arsenal 0-2 Liverpool
E don finish! Liverpool don close di gap to just ONE point on Manchester City.













