How four-year-old boy die afta im neck hook for stair gate

Wia dis foto come from, Family Photo
One four-year-old boy die afta im neck hook between two stair gate wey dem position ontop each oda, investigation reveal am.
Dem find Draco Chapman unresponsive for im house for Norwich on 2 April 2019, and die three weeks later.
For investigation dem find out say Draco neck dey trap as im try climb between di stair gates, wey cause cardiac arrest and brain damage wey dem no fit reverse.
Coroner Johanna Thompson conclude say im death dey accidental.
One serious case wey Norfolk Children Safeguarding Partnership review don recommend say all stair gates must come wit mandatory warning for dem not to dey fitted above another one.
Di coroner court for Norwich hear say Draco mama, wey dey 20-weeks pregnant at dat time, bin dey "find am hard to manage" and di house bin "dey out of hand".
For one statement, she say she fit one stair gate on top of anoda as di children fit climb over if na just one.
She say dis na to stop dem from getting out of di lounge and on top di stairs ", and to "stop dem from hurting themselves".
End of Di one wey oda users dey read well well
She say di court instruction no suggest say di gates no fit go on top each oda and she don see oda pipo do am before.

Wia dis foto come from, Family Photo
Family explain wetin really happun
On di day of the incident, she say di children bin go school and nursery, and then later go McDonald's as a "Tuesday tradition".
She say she bin don go one parents' evening and leave her eldest child, wey don be 19 now, to look afta di younger ones.
Wen she reach house, she say her eldest dey on di phone dey call ambulance service and e dey "scream Draco no dey breathe".
Dem carry di four-year-old to di Norfolk and Norwich University Hospital before dem transfer am to Addenbrooke's Hospital for Cambridge.
Draco bin get Noonan syndrome - one genetic condition wey fit cause different kain health problems. Im mama statement say e get heart abnormalities, e small for im age and get mental age of a two-year-old.
Dem later comot am from life support and transfer am to Quidenham Children Hospice for Norfolk wia im die on 23 April 2019.
In conclusion, Norfolk assistant coroner Ms Thompson say di serious case review refer to videos on YouTube about using double stair gates, add say "issues fit dey wey dem need address".
Speaking afta di inquest, Draco papa say im son dey "mischievous at times, but in a loveable way" and im death don destroy di family.

















