Davido wema bank: Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react as Davido beg for money

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Instagram/Davido

Davido money don pass 151 million naira within hours afta im fundraiser wey im bin start "like joke".

Davido wey real name na David Adeleke post say im don get ₦151,458,030.52 for im wema bank account wey e dey collect di contribution.

Di Assurance star wey go clock 29 years old on November 21, 2021 say e wan use di money take clear im Rolls Royce from port.

Na within hours wey im post dis request on im verified Twitter account and Insta story on Wednesday na im Davido get dis money dem.

Di mata burst pipo head throughout di day wen Davido call out for pipo to donate one million naira give am.

So far pipo from fellow DMW star, Perruzzi to Big Brother Naija celebs dem like, Nengi and Dorathy to even di mama of im first pikin Sophie Momodu, don drop bar (di money).

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Davido

Wetin we call dis foto, Davido na pikin of Billionaire Adeleke

Davido donation: How celebs react

And yes, Davido wema bank account hit don start to dey also make oda celebrities dem tink dia own mata.

Real Warri Pikin

Anita Asuoha, wey be comedian wey dey call her self di Real Warri Pikin post video wia she siddon for inside shower with towel for bodi.

According to di comedian; "I past account number for status and story since 6am, and 14 hours later na N8,200 dey inside."

E be like dis scope no work for evribodi.

Don Jazzy

Mavins Oga, Don Jazzy enta im own social media to remind im fans say im birthday na just five days afta di Fem star.

For video post wey im caption 26th Nov, oga Don Jazzy sing say, "Who fit tell me why I happy? Because my baiday don dey come."

On top dis reminder of im birthday, e don dey clear wetin e dey expect.

Teni Entertainer

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Teni Entertainer

Hours afta di Davido donation, Singer Teniola Apata popularly know as Teni di entertainer write for her social media page say:

"December 23rd still far oh, na why I wan start my own today. Make I no go hear sey!!!!!! Because Ahhhhhhhhhhhhh!!!!!!! Hmmnnnnnnnnnnn!!!!!! Oyah oyah oyah oyah"

Obi Cubana

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Instagram/Obi Cubana

Wetin we call dis foto, Obi Cubana na Nigerian socialite

Obi Cubana wey be businessman no miss for inside di trend say im sef wan post im account number say, "make I try something".

You go remember say for July of dis year, im loud im mama burial for Oba, Anambra State.

Tori be say na one of im friend bin contribute di cows wey dem use for di burial and di burial trend with di way im friends bin dey spray money dat weekend.

Sha na im know wetin im wan try sha.

Simi

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Twitter

Afta Davido show say her husband don contribute im own N1m to di movement.

Simi come post for social media, say "simiarmy", and afta pipo comment on dat one, she calm down say, "make dem recover from today own fes".

PSquare

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, PSquare

Peter Okoyo on Thursday morning cari enta im official page post bank account number wey show im twin Paul Okoye.

E write "... make we show dem say two heads dey beta than one..... evritin na double-double.

Davido wema bank: Davido latest news make Don Jazzy, Real Warri Pikin, Obi Cubana, Simi react to donation for David Adeleke Birthday date

Wia dis foto come from, Davido

Davido birthday date, profile

Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010.

Born on 21 November, 1992 di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry

Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians.

Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. He also dey signed on many endorsement.

For 2008, he make di Forbes Africa 30 Under 30 list.

Davido get 9.7 million followers on Twitter.