G7 leaders - Canada, US, UK, odas promise one billion covid-19 vaccine doses to poorer nations

Wia dis foto come from, EPA
Leaders of di major industrial nations don pledge one billion Covid vaccine doses to poor kontrie as a "big step towards vaccinating di world", UK Prime Minister Boris Johnson don tok.
At di end of di G7 summit wey hapun for Cornwall, di PM say kontries dey reject "nationalistic approaches".
E say vaccinating di world go show di benefits of di G7 democratic values.
Dem also make a pledge to wipe out dia contribution to climate change.
Afta di first meeting of world leaders in two years, Mr Johnson say "di world bin dey look to us to reject some of di selfish, nationalistic approaches wey come with di first global response to di pandemic and to put all our diplomatic, economic and scientific might to defeat Covid for good".
E say di G7 leaders bin pledge to supply di vaccines to poor kontries either directly or through di World Health Organization Covax scheme - including 100 million from di UK.
Dis pledge from di G7 dey come afta UK tok say dem go begin donate coronavirus vaccines give poorer kontris in di next few weeks.
More dan 100 million surplus doses go dey delivered for next year, PM Johnson give di informate before di G7 summit.
End of Di one wey oda users dey read well well
US President Joe Biden also bin promise to send 500 million doses of Pfizer vaccines give 92 low and middle-income kontris plus di African Union.
UK go give five million doses by di end of September and 25 million more by di end of di year.
Why UK, US, odaswan supply millions of vaccines to poorer kontris
UK Prime Minister bin say: "Sake of di result of di success of di UK vaccine programme we now don dey for position to share some of our surplus doses wit dos wey need dem.
"As we do am like dat, we dey take giant step towards beating dis pandemic for good".
Before di G7 summit, Johnson bin say e hope say im fellow leaders for di summit for Carbis Bay, Cornwall, wey go start on on Friday; go "make similar pledges so dat, together, we go fit vaccinate di world by di end of next year".

Di leaders of Canada, Japan, France, Germany and Italy plus di US and di UK, also dey set out plan to expand vaccine manufacturing to help hit that goal.
Oga Biden wen e dey tok for Cornwall, say: "Di United States dey provide these half billion doses with no strings attached. No strings attached.
"Our vaccine donations no include pressure for favours, or potential discounts. We dey do dis to save lives
Who go get dis vaccines?
Dis no go be di first contribution to global vaccination by di UK goment - UK don already donate more dan £500m to Covax, di scheme wey dey distribute vaccines to di world poorest kontris.
Plus e don help develop di Oxford-AstraZeneca vaccine, wey dey available at cost price - two-thirds of di 400m doses dey go to low and middle-income kontris, including 170m to India.
Oga Johnson want make di G7 leaders to encourage oda pharmaceutical companies to also provide vaccines at cost price, as di pandemic still dey.
About one fifth of di doses wey UK go donate go dey delivered through specific agreements wit kontris wey need am, dem go donate di rest through Covax.

Vaccines minister Nadhim Zahawi wey e dey follow BBC tok agree say even wit di G7 donation pledges, vaccine no go still reach to vaccinate everybody and e call on manufacturers to increase production across di world.
E add join say, nobody for UK go need wait any longer for vaccine sake of di kontri contribution to global effort.
Oga Zahawi say goment don order more dan 500m doses of seven of di most promising vaccines, including di four wey don dey so far approved for use.
E dey hoped say di surplus doses of vaccine go help prevent di spread of di virus around di world and in doing so, stop di emergence of more new variants.
Announcement of di donation dey come afta UK do reverse on their commitment to spend 0.7% of national income on overseas aid, instead make dem cut am to 0.7% Ake of di pandemic effect on public finances.
Di donation of vaccines go count as extra aid spending on top of di £10bn wey di goment promise under reduced target.






![Meghan Markel Lilibet: Prince Harry and Meghan no ask Queen Elizabeth II before naming dia baby Lilibet [Queen Elizabeth and Prince Harry]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/660/cpsprodpb/16AA4/production/_118863829_meghanmarkellilibetprinceharryandmeghannoaskqueenelizabethiibeforenamingdiababylilibet-queenelizabethandprinceharry.jpg.webp)







