Omoyele Sowore shot: Police deny shooting Sowore for Abuja Unity Fountain

Wia dis foto come from, Sahara Reporters
Nigerian activist, Omoyele Sowore post for im social media page allege say police shoot am for leg on Monday as im dey hold a protest.
Sowore wey dey ginger for Buhari Must Go protest, tweet say police officers shoot at am for Abuja Unity Fountain in di morning inside di kontri capital.
But di police say dem no get hand for Sowore shooting.
Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.
Eyewitnesses say one police officer fire teargas at di gathering and di canister hit di publisher wey fall down on di spot.
![Omoyele Sowore "Omoyele Sowore": [Sowore shot]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/180B3/production/_118738489_omoyelesoworeomoyelesowore-soworeshot.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Twitter/@YeleSowore
Di 50 year old publisher of Sahara Reporters bin don dey ginger for one "#RevolutionNow" protest for Nigeria since August 2019.
Sowore allege say as im pipo dey try organise one protest waka on top security mata for di kontri. Before dem go know, dem hear gunshot, and then di bullet hit Sowore for leg.
Di tori be say, Sowore and oda protesters bin land di Unity Fountain in di morning wia dem go wait for di entrance.
End of Di one wey oda users dey read well well
For Twitter post Sowore show picture of im injury and also call on di struggle to continue even if dem kill am.
![Omoyele Sowore "Omoyele Sowore": [Sowore shot]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/17505/production/_118739459_omoyelesoworeomoyelesowore-soworeshot.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Sahara Reporters
Abuja police tok tok pesin, Yusuf Mariam explain say di police professionally restore calm afta some group of protesters dey try incite public disturbance.
Police say di tori wey di waka say na female assistant of Police shoot am for Unity Fountain no be true.
She further explain say di protesters action fit cause di breakdown of law and order.
Di police tok tok pesin also urge Abuja pipo make dem liver no cut dem and make them remain calm.
Di command dey do everything possible te ensure the safety of dia lives and property, Yusuf Mariam add.
'Sowore shot' wetin hospital tok?
Afta di police hit di activist, dem rush am to Wellington hospital for Abuja.
At di time our reporter call di hospital to confirm weda dem bring Omoyele Sowore come dia, dem say yes.
But dem no tell weda na shoot- dem shoot am or weda na just injury e get.
Report wey reach BBC News Pidgin show say e don comot from di hospital.
Tori be say Sowore go like make im personal doctor attend to am.
Omoyele Sowore - Nigeria activist, journalist and presidential pandidate
Meet Omoyele Sowore
- Omoyele Sowore no be today meat, na since di days of June 12, 1993 na im e begin ginger for Nigeria mata.
- Him na son of Ilaje land for Ondo State, South West Nigeria.
- Born February 17, 1971, Sowore na human rights activist, pro-democracy reformer.
- Na him be di founder of tori pipo, Sahara Reporters wey e start for 2006 inside one small room for Manhattan, USA.
- He get Bachelor's Degree (Geography and Regional Planning) University of Lagos from 1989 to 1995 (But e get two extra years sake of Aluta ginger).
- E become Student Union Goment (SUG) President, University of Lagos between 1992 and 1994 (E follow lead serious protest against military goment wey bin cancel June 12, 1993 Presidential election and fight against goment corruption).
- He also get Master's Degree (Public Administration) from Colombia University.
- E become Presidential Candidate of di African Action Congress during di February 2019 Presidential election for Nigeria.
Sowore ('Showore' as dem dey pronounce am) na Nigerian wey don spend di last 15 years to dey work to promote human rights and democracy inside Nigeria.
Im also chop jail sentence to stop di military rule and gbege wey foreign oil companies cause for im kontri.
For 1989, Sowore follow for student 'I-no-go-gree' waka to protest di conditions wey dey inside one International Monetary Fund (IMF) loan of $120 million goment bin wan use for one Nigerian oil pipeline construction.
Dat IMF loan conditions na to reduce di number of universities in di kontri from 28 to just five.
For 1992, wen im dey University of Lagos, Sowore lead 2,000 students in protest against Nigeria corrupt leaders.
Police open fire, kill seven. Sowore chop arrest ontop di mata but he no gree to back down im Aluta struggle for decent education inside im kontri.
For early 2018, Sowore launch im presidential election campaign wit 'Our Mumu don do' slogan wey e say na mistake say young pipo comot hand for Nigeria mata.
Di 48 year old don enta imprison eight times before now ontop dis Aluta struggle for Nigeria.














