John Pombe Joseph Magufuli dies: Samia Suluhu swear in as Tanzania first female President afta Magufuli death go easy?

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President
Wetin we call dis foto, Vice President Samia Hassan Suluhu, age 61, suppose assume di office of di president for di remainder of di five-year term wey Magufuli begin to serve last year after winning a second term, according to Tanzania Constitution,

Mama Samia Suluhu Hassan wey be Vice President since 2015 suppose take over as Tanzania first female President by now as John Pombe Joseph Magufuli don die.

Sabi pipo don begin tok about wetin concern di smooth transition of power for Tanzania since dia President John Magufuli, die on Wednesday.

Tanzania opposition leader Zitto Kabwe, of di ACT Wazalendo party wey just lose dia leader for Zanzibar to COVID-19 tell BBC say goment must immediately transfer power sharp sharp to di Vice President Samia Suluhu Hassan to avoid constitutional uncertainty.

According to Kabwe, di law book alias constitution of Tanzania make provision for di Vice President to continue wetin remain of Magufuli five-year term.

Fulgence Massawe, wey be Lawyer for anoda interview also tell BBC say as far as di constitution dey concerned Samia Hassan go occupy Office of di Tanzanian President till 2025.

According to Tanzania Constitution, Vice President Samia Hassan Suluhu, age 61, suppose assume di office of di president for di remainder of di five-year term wey Magufuli begin to serve last year after winning a second term.

Vice President Samia Hassan Suluhu go be di East African nation [Tanzania] first female president.

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Madam Samia Hassan Suluhu go become di sixth president of Tanzania and di second from Zanzibar.

All dis tok dey come out sake of say some of di kontris for East Africa get Leaders wey dey like to dominate and dis dia domination don lead dia kontris into crisis.

Rwanda, Somalia, Somaliland, Eritrea, Ethiopia, Uganda, Kenya, Burundi, Comoros, Djibouti, Madagascar, Malawi, Mauritius, Réunion, Seychelles, Tanzania, na di kontris wey make-up East Africa.

History show say almost all di kontris for East Africa region don experience crisis as e take concern change of goment.

But as di world dey change and adjust to give women chance for govment, pipo expect say Tanzania Vice President Mama Samia Suluhu Hassan as pipo dey popularly call her, suppose take over from Magufuli witout gbege for di kontri.

Samia Suluhu Hassan na di current Vice President of Tanzania and dey born her January 27, 1960 (she be 61-year-old.)

Hassan, come from di semi-autonomous region of Zanzibar, wey be about 99% Muslim - she study statistics for Zanzibar Institute of Financial Administration and later graduate from Mzumbe University for 1986 with Advanced Diploma in Public Administration.

She also attend University of Manchester wia she receive postgraduate diploma in Economics for 1994.

She be Tanzania first female Vice-President as she enta di office for 2015 and reports say mama Hassan get di backing of some factions inside Chama Cha Mapinduzi (CCM), di ruling party wey support former President Jakaya Kikwete, especially those from Muslim communities.

However e fit be say e get some oda factions for Tanzania ruling party wey dis current arrangement - whereby Mama Samia go succeed Magufuli - no favour.

BBC Pidgin find out say under normal circumstance, with 24 hours wey dem comfam di death of a serving president for Tanzania, dem suppose immediately swear in di Vice President - in dis case - Mama Samia Suluhu Hassan.

But 24 hours don pass since dem confam Magufuli death and di law book of Tanzania favour Mama Samia as di next leader and as at Thursday night dem never swear-in Suluhu.

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President
Wetin we call dis foto, Madam Samia Hassan Suluhu

"If di office of di president alias Presidency become vacant due to di President death, resignation, loss of electoral credentials or incompetence due to physical illness or failure to perform the functions and duties of di President, then di Vice-President na im dem go swear in and go remain in office for di remainder of him term. five years ... "

Na so di constitution of Tanzania in section 37 (5) tok.

E dey possible say on Friday 19 March, 2021 at 10am local time dem go likely swear in VP Samia Suluhu as Tanzania first female President, from wetin BBC Pidgin dey monitor from di East African kontri.

And wen dem finally swear in Mama Samia Suluhu, she go join di list of female presidents in Africa, wey no plenty.

See Women wey don lead African kontris as President till date

Slyvie Kiningi na di first and only woman up to date to become president for Burundi.

She serve as Prime Minister of Burundi from 10 July 1993 to 7 February 1994, and acting President from 27 October 1993 to 5 February 1994.

After di killing of Melchior Ndadaye by Tutsi insurgents on 21 October 1993, dem swear in Slyvie Kiningi wey be di prime Minister at dat time to become Acting President.

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Ms Sirleaf in 2010

Ellen Johnson Sirleaf make history in 2006 as Africa first elected female president.

Ellen na di first elected female President of Liberia and she serve till 2018.

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Rose Francine Rogombé

Rose Francine Rogombé - become Acting President of Gabon after di death of Omar Bongo in 2009

She constitutionally succeed President Bongo sake of her role as President of di Senate.

Rogombé na di first female head of state of Gabon. After her interim presidency, she return to her post as President of di Senate.

Monique Ohsan Bellepeau become Acting President of Mauritius after Sir Anerood Jugnauth resign from office for 2012.

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President
Wetin we call dis foto, Joyce Banda

Joyce Banda become President of Malawi afta di death of Bingu wa Mutharika from 2012 to 2014.

Catherine Samba-Panza serve as di di female transitional President of Central Africa Republic from 2014-2016

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ameenah Gurib-Fakim

Ameenah Gurib-Fakim na di second female President of Mauritius, she bin dey elected by parliament in 2015 and she serve for three years until 2018

"Magufuli dead" [Kifo cha Rais Magufuli] John Pombe Joseph Magufuli dies: "Samia Hassan Suluhu" swear in as Tanzania first female President

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, President Sahle-Work

Sahle-Work Zewde na di President of Ethiopia, also elected by parliament. Sahle don dey serve as Ethiopia leader since 2018 till present.