Yoweri Museveni win Uganda election 2021: Electoral Commission say di president beat Robert Kyagulanyi AKA Bobi Wine

Wia dis foto come from, Yoweri Museveni
Uganda long-time President Yoweri Museveni don dey re-elected, according to electoral officials, ontop accusations of vote rigging by im main rival Bobi Wine.
Mr Museveni win almost 59% of di vote, with Mr Wine wey come from behind with about 35%, di Electoral Commission tok.
Mr Wine, wey be former pop star, don earlier vow to provide evidence of fraud. Di Electoral Commission deny say vote-rigging happun for Thursday election.
Sabi pipo wey monitor di elections don criticise di government say dem block internet access.
Mr Wine say e go provide evidence of fraud once di internet don dey restored.
Dis result give President Museveni a sixth term in office.
Di 76-year-old - wey don dey power since 1986 - say e represent stability for di country.
Meanwhile, Bobi Wine - wey be di stage name for 38-year-old Robert Kyagulanyi - say e get di backing of di youth inside one of di world's youngest nations, wia di median age na 16.
End of Di one wey oda users dey read well well
On Friday, as di results bin dey come in, Bobi Wine say Ugandan soldiers bin surround im home.
But one government spokesman accused am of "dramatising" di incident "to seek sympathy".

Wetin be di latest on di election results?
"Di electoral commission declare Yoweri Museveni... elected President of di Republic of Uganda," election commission chairman Justice Simon Mugenyi Byabakama tok on Saturday.
E say di turnout na 57% of di almost 18 million registered voters.
Di opposition candidate believe say di internet shutdown na something dem use to block communication and fit compromise di vote.
"I go dey happy to share di videos of all di fraud and irregularities as soon as di internet dey restored," Bobi Wine tok.
Meanwhile, Mr Wanyama, wey be spokesperson for President Museveni, hit back at Bobi Wine claims of vote rigging.
"E come short of di expectation of Ugandans," E tok for interview with BBC. "E no get message and Ugandans don tell am to wait a little longer."
Mr Wanyama add: "We don challenge am to provide proof for im claims, e no get single evidence."
EU, United Nations and several rights groups bin raise concerns about di integrity of Uganda election.
But, aside from di African Union mission, no major international group monitor di vote. Earlier dis week the US - a major aid donor to Uganda - cancel dia diplomatic observer mission to di country, say dem deny di majority of dia staff permission to monitor polling sites.

Wia dis foto come from, AFP
Who be Yoweri Museveni?
Mr Museveni, wey come to power on di back of one armed uprising for 1986, stand as leader of di National Resistance Movement (NRM).
Dem don since dey portray am to Ugandans as liberator and peace bringer.
But di BBC Patience Atuhaire say e don manage to maintain im grip on power through a mixture of encouraging a personality cult, employing patronage, compromising independent institutions and sidelining opponents.













