Bobi Wine: Uganda election 2021 presidential candidate Robert Kyagulanyi cry out as EU and US observers no go show

Bobi Wine, Uganda presidential candidate

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bobi Wine, Uganda presidential candidate
Read am in 1 mins

Uganda opposition presidential candidate don raise alarm say less dan 24 hours to di kontri elections, US observers neva get accreditation.

On Thursday January 13, Uganda pipo go vote for presidential and parliamentary elections, but major opposition presidential candidate, Robert Kyagulanyi Ssentamu alias Bobi Wine, say di goment first “refuse to invite EU Mission to come observe di election,” and now dem don also deny US accreditation.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Oga Wine yan dis one for post wey im do for Twitter in reaction to announcement wey di US ambassador to Uganda tweet say, as Uganda decide to delay more dan 75% of dia accreditation request dem don decide “not to observe,” di election.

Meanwhile, UN Special Rapporteur Freedom of Association don express worry on top allegation say internet shutdown and blocking of access to social media platforms as di kontri dey prepare for di general elections.

Di join bodi say, “access to information and communication tools dey critical for fair, transparent and peaceful elections.”

Inside one television speech wey im dressed in military jacket on Tuesday night, Uganda President Yoweri Museveni say im order di shut-down accusing social media giant Facebook of arrogance and say dem dey take sides.