Diary Sow: Senegal 'best student' wey disappear for France say na break she take to regain her senses

Diary Sow

Wia dis foto come from, SENEGALESE PRESIDENCY

Wetin we call dis foto, Dem declare Diary Sow missing afta she fail to show face for classes afta Christmas
Read am in 2 mins

A gifted Senegalese student and novelist Diary Sow wey dem declare missing for France don come out to say ''sorry'' for disappearing.

Dem report Ms Sow wey be 20 years of age missing for early January wen dem no see her for classes afta Christmas.

French prosecutor bin open investigation into di her disappearance wey cause concern for Senegal and France.

But for one letter wey she sent to Senegal's Water and Sanitation Minister Serigne Mbaye Thiam, Ms Sow tok sorry say she only take ''small break to regain her senses''

She say she no dey under any kain pressure and further tok sorry to di pipo wey dey worry about her.

''I no dey hide. I no dey run away. See am as a kain welcome respite from life'' she write.

Ms Sow say her di reason why she no show face for school for January gats nothing ''to do with overwork, or madness, or di desire for freedom''

''I no dey sorry say i comot, i dey sorry for di pipo wey dey worry sake of say i no show face'' she tok.

Di minister say Ms Sow and her family bin give im permission to release excerpts from di letter for im twitter account.

''Na me get di tweet,'' Oga Thiam , wey dey sponsore Ms Sow as Senegal's education minister for plenti years tell AFP news agency.

File picture of the Lycée Louis-Le-Grand

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Diary Sow is a student at the prestigious Louis-Le-Grand high school

French prosecutors torchlight how Dairy Sow disappear for Paris afta Christmas

France don open investigation to torchlight how di most talented Senegalese student wey dey study for one ogbonge school for Paris take disappear.

Diary Sow no return back to school afta di Christmas holidays and dis don cause panic for Senegal and France.

Many pipo describe her as "di best student for Senegal", as she don win plenty national academic prizes and she publish her first novel last year.

She be 20 years old and nobdy don see her since 4 January.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Senegalese wey dey live abroad don dey mobilise support to find her. Plenty French celebrities, including actor Omar Sy, also dey beg pipo for any information on her wia about for dia social media handles.

He retweet dis report:

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Sow na second-year pre-university student for one Parisian high school Lycée Louis-Le-Grand, and she bin get scholarship for excellence.

"She dey punctual, very serious student, and di alert come quickly. Nobody see her, we no find her for her apartment" for di university residence for Paris, Henry Sarr, wey be member for di association of Senegalese students wey launch di appeal on social networks, tell AFP news agency.

One member of di Senegalese community for Paris Daouda Mbaye wey organize di distribution of leaflets to get informate about her waka tell AFP."Neither her parents, nor her friends, guardian or di embassy get any news about her.