Coronavirus: US President Donald Trump sign economic relief bill into law

Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Donald Trump

US President Donald Trump don sign into law one coronavirus relief and spending package bill, to stop partial government shutdown.

Initially, Trump bin refuse to sign di bill, as im say e want to give people bigger one-off payments.

Di delay come make millions of Americans temporarily lose their unemployment benefits.

After months of tok-tok, Congress approve di relief package wey worth reach $900bn (£665bn).

Di money dey part of $2.3tn spending package wey include $1.4tn for normal federal government spending.

If to say Mr Trump no sign di bill into law by midnight on Monday, partial government shutdown for don start unless legislators pass stopgap bill.

About 14 million Americans bin face lapse in unemployment benefit payments and new stimulus cheques. Unemployment benefits go now dey restored.

US President-elect Joe Biden bin warn of "devastating consequences" if oga Trump continue to delay di signing but di Saturday deadline don already pass.

For inside tweet late on Saturday evening local time, oga Trump bin defend im position on top di mata, as e blame China for di coronavirus outbreak.

Tweet Screen grab

Wia dis foto come from, Twitter

Wetin we call dis foto, Donalad Trump

E no dey immediately clear why oga Trump - wey dey for Florida - finally decide to sign di bill into law. Im bin don dey under growing pressure from both sides of Congress.

Trump say im bin sign di bill with "strong message wey make clear to Congress say dem need to remove wasteful items".

Im go comot for office on 20 January after e lose di November 2020 election to Mr Biden, although im don refuse to admit defeat.