Otto missing children: Anoda 4-year-old pikin don miss for area

Wia dis foto come from, Facebook/Ibina Chigozie
Anoda four year old pikin don go missing for Otumara Community a neighbouring place to Otto, for Lagos, South West Nigeria.
Dis one happun on Wednesday, 19 August 2020, only few weeks afta di last of di five pikin dem wey don miss for di community.
According to di father of di pikin, di little girl, Rosemary, bin dey play in front of dia domot for around 6pm on Wednesday wen she be go missing.
Otto community don witness plenty case of missing children.
BBC Pidgin earlier report how five children lost for di community within 18 months and dem neva find dem till now.
For di community meeting between di police and di community leaders wey happun on Wednesday, dem say nine children don miss within Iddo-Otto and Otumara communities between June 2019 to August 20, 2020.
Some of di mothers of di missing children wey follow BBC Pidgin tok say dem still dey feel di pain of dia lost children.
"One woman don run mad and dem carry her go village," one of di mothers wey still dey find her pikin tell BBC Pidgin.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Agbodemu
Ibina say di mother of Rosemary leave am small to enter house and before she comot di girl don disappear. He add say neighbours no dey outside wen di incident happun.
"I don dey go from one police station to police station to report. I no know wetin else to do," di father of di girl tell BBC Pidgin.
We still dey investigate
The tok-tok person of di Lagos State Police Command, Bala Elkana, say di police still dey investigate di matter and dem don declare di children missing.
"Di last case wey I check, di pikin be four and dey miss under different circumstances. I sabi di pains of di parents but investigation dey take time," Elkana tell BBC Pidgin for previous report.
For di council meeting of all di leaders wey police call to find solution to how pikin dey quick miss for di area, Area commander Fatai Tijani, say make di community support dem to work effectively.

Wia dis foto come from, Agbodemu
Di community leaders (Chiefs, Baales, CDA and CDC) all get roles to play, dey need to appoint volunteers to work with di police so as to bring an end to the issues bothering the Communities".













