Katy Perry and Orlando Bloom announce di birth of dia baby Daisy Dove Bloom

Wia dis foto come from, Getty Images
American singer, Katy Perry don give birth to her first pikin, baby girl at di age of 35.
Na her bobo, actor Orlando Bloom announce dis one for im social media say dem dey lucky to give birth for peace even for dis coronavirus time.
Dem share di news of di birth of dia baby girl Disy Dove Bloom to UNICEF wey dem dey both be Goodwill Ambassadors for.
"Welcome to di world, Daisy Dove Bloom! We dey honoured to introduce Goodwill Ambassadors Katy Perry and Orlando Bloom new bundle of joy,"
"Mom, dad and child dey do fine. "We dey float with love and wonder from di safe and healthy arrival of our daughter," na so statement from UNICEF tok.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Na for April di couple bin announce di gender of dia firstborn ontop Instagram post.
Perry and Bloom start rumour say dem dey date for January 2016, wen pipo sight dem dey dance togeda for di Golden Globes afta party. Dem break up briefly for 2017, before dem connect again.
Na still online di couple announce dia pregnancy for February 2019 for inside Perry music video "Never Worn White".
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Capitol Records
Bloom don already get nine-year-old son Flynn with im ex-wife, Australian model Miranda Kerr.
Di British actor, wey pipo sabi well for im roles inside Lord of di Rings and Pirates of the Caribbean, propose to Perry for February 2019; and her Never Worn White song bin hint say di couple plan to walk down di aisle soon.
"I've never worn white / But I wanna get it right / Yeah, I really wanna try with you," Perry sing for di chorus. "No, I've never worn white / But I'm standing here tonight / Cause I really wanna say 'I do.'"












