Bella Thorne OnlyFans: American actress break record for her OnlyFans account as she make $1million within 24 hours!

Wia dis foto come from, BELLA THORNE/INSTAGRAM
Bella Thorne don break record as she become di first actress to make over $1 million dollar from one social media platform OnlyFans 24 hours into wen she open di account, according to di company.
Di site dey popular for adult and x-rated content wey pipo dey pay moni to enta and di site dey attract many celebrities recently, including rapper Cardi B, "Real Housewives of New York" stars Sonja Morgan and Dorinda Medley, model Blac Chyna, rappers Swae Lee, Rico Nasty, and The-Dream, and "Love & Hip-Hop" stars Safaree Samuels and Erica Mena all of dem dey participate for di platform.
Di former Disney star tell Los Angeles Times say e get plenty reasons why she dey OnlyFans, one na to do research for one film she dey work on wit Sean Baker, di director wey dey behind films like The Florida Project and Tangerine.
She don use di platform share personal content, fotos and videos wey she neva release to public before and pipo dey pay $20 per month to watch am.

Wia dis foto come from, BELLA THORNE/INSTAGRAM
Last year di former Disney star receive di Vision Award from Pornhub for her first adult film "Her & Him."
Thorne tell Los Angeles Times say she dey plan to use di moni wey she make for OnlyFans for her production company and to donate give charity.










