Cardi B attack Melania Trump speech for 2020 Republican National Convention and share her naked photo for social media

Wia dis foto come from, Instagram/iamcardib/melania
American rapper, Cardi B attack Melania Trump, di US First Lady for twitter, afta one former Republican Congressional candidate, DeAnna Lorraine say 'America need more Melanias and less Cardi B.'
DeAnna Lorraine wey don bin criticise Cardi B music before put out di tweet to praise Melania afta her closing Speech to support her husband during di Republican National Convention.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
E no waste time Cardi B reply back di tweet with vulgar word and even post naked picture wey Melania bin snap for 1995 foto shoot with former French Magazine Max.
Cardi even quote some vulgar lyrics from her song as she post di naked foto of di first lady for Twitter.
Neither Melania trump nor her husband don respond to di tweet from Cardi B.
Wetin Melania Trump speech be during Republican National Convention?

Wia dis foto come from, Reuters
Di US first lady deliver Tuesday evening keynote address before small audience for di White House.
Her decision to speak from di seat of presidential power alias White House don vex Democrats, wey claim say di chosen venue na inappropriate use of goment resources.
"Like all of you, I don take time think about di racial unrest wey dey happun for our kontri," Melania Trump tok
End of Di one wey oda users dey read well well
"Ds na harsh reality wey we no dey proud of parts of our history. I dey encourage you to focus on di future while you dey still learn from di past."
"I urge pipo to come togeda in a civil manner so we go fit work and live up to our standard American ideals.
"I dey also ask pipo to stop di violence and looting wey dey hapun all in di name of justice, and neva make assumptions base on di colour of pesin skin. Instead of tearing things down, make we think about our mistakes."

Wia dis foto come from, Cardi B, Melania Trump
Melania Trump also yarn say her husband go deliver for American working families, wey she describe as "di backbone of di kontri".
"No matter di amount of negative or false media headlines or attacks from di oda side, Donald Trump neva and no go lose focus on you."
"E love dis kontri and e knows how to get things done. As you don learn ova di last five years, e no be traditional politician."
She add later for her speech say: "Weda you like it or not, you always know wetin e dey think about."














