Barack Obama blast Donald Trump say e dey treat di US presidency like "one more reality show"

Wia dis foto come from, Getty Images
Former US president Barack Obama don accuse di present president, Donald Trump say im dey treat di US presidency like "one more reality show"
Oga Obama wey tok dis one during im speech for di Democratic convention, add say Trump 'neva still grow to sabi di job of a president because e fit learn di work'
E no waste time at all, President Trump fire back say Americans elect am as president because of di horror wey Obama leave for United State.
Wetin Obama tok about Trump

Wia dis foto come from, Reuters
Barack Obama wey be former US president unleash plenti attack against preisdent Trum as im dey tok from di Museum of di American Revolution inside Philadelphia.
- Barrack Obama say "oga trump neva show any interest to put for im work. No interest to find solution or agreement for issues."
- E say "oga Trump no get interest to treat di presidency as anything but like reality show wey e fit use to get di attention wey im want."
- Obama say "oga Trump no get any interest to use im ogbonge power of office to help anyone but imself and im friends."
- E say di result of Oga Trump presidency don "bring out di worst side of Americans, reduce di proud reputation of US around di world and threaten di kontri democratic institutions like neva before".
Former US presidents mostly dey keep quiet for public for mata wey concern dia successors but Obama cut rope for Trump mata.
Obama don first sama warning four years ago wen e still dey office say; if Americans elect Mr Trump as president, e go regard dat as "personal insult."
On Monday nigh tfor Democratic convention, Obama wife, Michelle delivered one heavy speech wey she for attack Trump and call am incompetent.
End of Di one wey oda users dey read well well
How President Trump take respond

Wia dis foto come from, EPA
During one White House news conference on Wednesday, tori pipo ask President Trump wetin im think about di tins wey Barrack Obama tok, e come reply say;
"I see di horror wey im leave us and di stupidity of di transactions wey im make."
"Look at how bad e dey, how e no work well as president, e dey so ineffective, so terrible."
"President Obama no do a good job, and di reason I dey here now as president, na because of Obama and Joe Biden."
President Trump add say; "Two of dem do very bad job na im make I stand before you as president."
Later for one tweet, President Trump say; "Welcome, Barack and Crooked Hillary. See you on di field of battle!"













