White House Shooting: Trump briefing stop afta dem hear gun shot near White House

Wetin we call dis Video, Trump rushed out of press conference

America Secret Service agent bin escort President Donald Trump comot sharply from one press conference afta Secret Service agents shoot and wound one man wey claim say im dey armed for outside di White House.

Di Secret Service tok say di incident happun one block from di compound, wen one officer fire di suspect wey dey run to rush am.

One agent later waka go meet oga Trump for stage wen im dey tok and lead am comot.

Di US Secret Service say di incident happun on Monday for di corner of 17th Street and Pennsylvania Ave - outside di White House perimeter.

Di security agent say di man wey dem sabi sabi, approach di officer and tell am say im get weapons, e come pose like say e wan shoot before di officer shoot am for torso.

Di Secret Service no tok if di man dey armed but dem add say dem don carry di officer and di suspect go hospital and di security of di White House no dey tampered wit for di time di incident happun.

Di president return nine minutes later to say di situation dey under control and dem shoot one man.

Oga Trump tell tori pipo say from wetin im understand and believe be say di US Secret Service bin shoot one suspect wey im believe dey armed. E say im no know if di pesin wan do am bad, di president tok.

US President Donald Trump follow secret service agent tok before e comot for one coronavirus briefing for di White House, August 10, 2020

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One Secret Service agent waka go stage and whisper something for President Trump ear when im dey do briefing

Oga Trump agree say di mata get as e be and e hail di professionalism of di USSS.

Di president say e dey bad say di world dey very dangerous.

He tell tori pipo say secret service bin escort am go di Oval Office outside di briefing room wen di incident happun.

Secret Service agents also lead di Treasury Secretary Steve Mnuchin and Office of Management and Budget Director Russ Vought comot from di news conference

Di District of Columbia fire department tok say a man dey suffer very serious injuries, according to di Associated Press.

Di news agency also dey report say authorities dey look whether di man get history of mental sickness.