Trump niece Mary write book wey damn di American president - See wetin dey inside

Wia dis foto come from, Trump Campaign
American Presido Donald Trump niece don set to release book wey she write about am, wey no go sweet im belle at all.
For 8 July, Mary Trump dey plan to comot di book, Too Much And Never Enough: How My Family Created the World's Most Dangerous Man.
Di book suppose comot just a few weeks before Presido Trump suppose accept im party nomination for im re-election bid for November.
Mary na Trump elder brother Fred Jnr Trump pikin.

Wia dis foto come from, Instagram/Donald Trump
So wetin di book go tok?
Na Mary make dem do investigate for Donald Trump money mata
Tori be say di book go tok how she bin gve di New York Times informate plus documents dem wey make dem torchlight how Trump dey make im money.
Di investigation wey win Pulitzer Prize bin tok say di president get hand for wuruwuru tax practices and collect pass $400 million today money from im papa real estate business.
Wetin make Donald Trump dey as im dey
According to small bit of di book from Amazon, di book go show how Donald Trump "turn to di damaged man wey currently dey di Oval Office, wey go include di strange and harmful relationship Fred Trump bin get with im two oldest pikin, Fred Jnr and Donald."
End of Di one wey oda users dey read well well
How im mistreat im papa wen e get Alzheimer's Disease
Tori also show say Mary wan accuse di presido say im mistreat and abandon im papa wen di man start to dey suffer from Alzheimer's.
Mary say she be beta source for all dis informate because she don see am as "first hand witness for plenti-plenti holidays togeda as family".

Wia dis foto come from, Getty Images
Mary Trump, 55, don dey dogde di spotlight since her uncle become presido as di beef wey dem get don last past 20 years, she and her broda bin sue to argue di money wey Fred Trump Sr drop for im estate.
Mary Lea Trump na PHD holder for Adelphi University New York and for 2012, tori be say she open one company wey she call Trump Coaching Group. .











