Beirut Explosion: Resignation of Lebanon Prime Minister Hassan Diab and Lebanese goment

Resignation of Lebanon Prime Minister Hassan Diab

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Lebanese PM Hassan Diab

Di entire Lebanese goment don resign afta Tuesday huge explosion wey happun for Beirut.

During di angry address to di nation di outgoing Prime Minister, Hassan Diab vex for wetin im call corrupt political establishment, wey im say dey disturb di work of im gomment.

Resignation of Lebanon Prime Minister follow Police and protestors clash in Beirut on Monday

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Resignation of Lebanon Prime Minister follow Police and protestors clash in Beirut on Monday

Di goment don bin dey under serious pressure to step aside afta di blast.

Many Lebanese dey vex say authorities allow make dem store large quantities of explosive material for Beirut port.

Plenti streets protests na im don go on, and some demonstrators don storm and ransack ministry buildings.