Lebanon before and after: Beirut explosion, oda bomb blast wey shake di Middle East nation

Wia dis foto come from, Twitter
Di explosion in Beirut, Lebanon wey happun on Tuesday kill many pipo, but no be di first time in history Lebanese pipo dey experience dis kain tin.
Casualty from di Beirut blast don rise to at least 100 deaths, according to Lebanon health ministry, while 4,000 odas na im injure.
Tori be say na 2,750 tonnes of ammonium nitrate wey dem be store unsafely inside one warehouse inside di port of Beirut cause di heavy explosion wey show mushroom cloud.
Na pesin bin try to import din ammonium nitrate chemical compound for 2014 but authorities impound am. Na dia dem begin investigate di mata, cari am go court. Di mata still dey for court before dis blast happun at about 15:00 GMT on Tuesday.
Dis na some of di major explosions wey don happen for Lebanon.


Rafiq Hariri bombing
One bomb inside truck bin explode, kill di former Prime Minister of Lebanon, Rafiq Hariri for Beirut for February 14, 2005. Di explosion also kill di former Minister of Economy, Bassel Fleihan and 20 oda pipo. Arouund 220 pipo bin wunjure. One group wey call diasef "Al Nusra and Jihad for greater Syria" bin claim say na dem do am.

Wia dis foto come from, AFP
Wissam al Hassan bombing
For 2012, Lebanon Head of the intelligence branch of the Internal Security Forces (ISF) Maj. Gen. Wissam al-Hassan bin die inside ogbonge car bomb for Achrafieh. Di bombing also eight oda pipo and wunjure 128 pipo.

Wia dis foto come from, Reuters
Roueiss bombing
One car bomb attack for di Roueiss community for south Bierut bin kill 27 pipo and wunjure ova 300 for August 15, 2013. Di attack bin target di Hezbollah stronghold.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bourj el-Barajneh bombing
For November 12, 2015, two suicide bombers bin kill 89 pipo and wound more than 200 odas for Bourj el-Barajneh, southern Beirut wey be Hezbollah stronghold.
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin to sabi about Lebanon
Lebanon, officially known as di Republic of Lebanon, na Middle East kontri in Western Asia. E get common bother wit Syria to di north and east and Israel to di south, while Cyprus dey west across di Mediterranean Sea.

Wia dis foto come from, Google Map
Religion in Lebanon
In general terms, di two largest groups na di Shiʿi Muslims and the Sunni Muslims, each comprising more than one-fourth of di Lebanese population.
Maronites, a Roman Catholic Eastern rite group wey come out from di region, make up more than one-fifth of di population. A number of oda Christian communities also dey present, including di Greek Orthodox and di Greek Catholics. Di Druze constitute a small percentage of di population but play an influential role in Lebanese society. E also a very small Jewish minority. According to britannica.com
Ethnicity in Lebanon
Lebanon get many different society wey come from a number of ethnic, religious, and kinship groups. Long-standing attachments and local communalism na im don dey tey tey before di creation of di present territorial and political entity and continue to survive wit remarkable tenacity.
Di Lebanese pipo compose a mixture in which Phoenician, Greek, Armenian, and Arab elements dey involved. Within di larger Lebanese community, ethnic minorities including Armenian and Kurdish populations also dey present.
Arabic na di official language, although smaller proportions of di population na Armenian- or Kurdish-speaking; dem dey also French and English too. Syriac na im dem dey use inside some of di churches of di Maronites (Roman Catholics following an Eastern rite).












