Missile strike in Lebanon?: Beirut explosion casualty dey increase as Lebanese dey spread 'missile' conspiracy - See wetin di port city look like now, plus French President Macron & world reactions
Pipo inside Beirut don express anger ontop di goment sake of wetin dem say be neglect wey lead to Tuesday huge explosion.
Na about 300,000 don dey homeless from di Lebanon explosion and di number of pipo wey die inside don rise to at least 137 according to Lebanon health ministry, while 5,000 odas na im injure.
Tori be say angry residents dey accuse authorities of corruption, neglect and mismanagement. Dozens of pipo still dey miss.
Many Lebanese pipo dey wonder whether na missile strike in Lebanon? as blast casualty dey increase BBC don find out say na just false and unfounded claims wey dey spread, blaming di "nuclear bomb" on di US, Israel or Hezbollah.

Wia dis foto come from, EPA
Lebanese Red Cross tok say dem dey worried say di number of casualty fit rise pass di current number of deaths as many pipo still dey miss from di blast wey happun around 15:00 GMT.
"Beirut dey cry, Beirut dey scream, pipo dey panic and pipo don tire," filmmaker Jude Chehab tell di BBC, as im begin call for di pipo wey dey responsible to face justice.
Meanwhile, Amnesty International and Human Rights Watch (HRW) don call for independent investigation into di blast.

Wia dis foto come from, EPA
Currently, rescue workers dey search rubble for di port of Beirut wia di explosion happun after di deadly blast.
End of Di one wey oda users dey read well well
Red Cross tanda dey coordinate wit di Health Ministry to set up mortuary because hospitals don full boku, one rescue worker tell Reuters.
Sara wey be nurse for Beirut Clemenceau Medical Center, describe wetin she see for her hospital afta di blast as "like a slaughterhouse, blood dey cover di corridors and di lifts".
Dis na wetin Beirut look like today afta Lebanon explosion

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, AFP
Tori be say na 2,750 tonnes of ammonium nitrate wey dem bin store unsafely inside one warehouse inside di port of Beirut cause di heavy explosion wey show mushroom cloud.
Na pesin bin try to import di ammonium nitrate chemical compound for 2014 but authorities impound am. Na dia dem begin investigate di mata, cari am go court. Di mata still dey for court before dis blast happun at about 15:00 GMT on Tuesday.
Di meeting of di Higher Defence Council, wey President Michel Aoun chair don declare a two-week state of emergency inside di capital Beirut afta cabinet session on Wednesday.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Twitter

Wia dis foto come from, AFP

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images

Wia dis foto come from, Getty Images
Even before Tuesday tragedy, Lebanon bin don already dey suffer under a number of major crises.
Di kontri currency don dey lose value against di dollar in recent months, leading to inflation and difficulties accessing basic goods.
On top of dis, Lebanon bin don dey deal wit major power cuts and oda problems over basic services.
Growing anger last year bin lead to mass protests against di big ogas for di kontri alias elite, wey eventually remove di goment.
Coronavirus don also make tins worse.
Di goment bin implement strict lockdown wey dem be relax for short period before dem reinforce am again.
How pipo dey react
World pipo dey react for social media wit different hash tags like #prayforbeirut #PrayForLebanon sake of di wetin happun for di port of Beirut inside Lebanon.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
United Kingdom
UK Prime Minister Boris Johnson express im readiness to help Lebanon in any possible way.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Even di Queen of England send sorry message to di pipo of Lebanon.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 5
United States
President Donald Trump don send im sympathies to Lebanon for di dozens of pipo wey don die and thousands wey wound inside di blast, wey di US President describe as attack, and offer US help.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 6
France
French President Emmanuel Macron express solidarity wit di Lebanese and tok say France dey send resources to di site of of blast.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 7

Wia dis foto come from, Reuters
On Thursday President of France Emmanuel Macron become di first world leader to visit Lebanon - wey be a former colony of France - since di tragedy. Na so many pipo gada Macron alias mob am as e waka around di city of Beirut.
Di French president tell crowds say im no go let di support from France to Lebanon alias aid go to "corrupt hands", and promise to call for a "new political agreement" from di kontri leaders.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 8

Germany
Di German foreign ministry say staff for di German embassy wound inside di explosion.
Iran
Iranian Foreign Minister Javad Zarif say Tehran dey ready to assist in any way and advice Lebanon to "stay strong".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 9
Qatar
Qatar Emir Sheikh Tamim bin Hamad Al Thani call President Michel Aoun to offer im sorry message, according to di state-run Qatar News Agency. Di Gulf kontri say dem go send field hospitals to support Lebanon medical response.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 10
Saudi Arabia
Saudi Arabia foreign ministry say dem dey follow with great concern di consequences of Beirut port explosion.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 11
Malaysia
Malaysian Foreign Minister Hishammuddin Hussein express im kontri grief sake of di Beirut blast, and offer to help in "any way dem fit".
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 12
Israel
Israel wey dey share common boundary wit Lebanon say dem don offer humanitarian aid to Lebanon through foreign channels, as di neighbours no diplomatic relations.
BBC Arabic office bin also shake gbim-gbim-gbim
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 13
See oda tori dem wey you fit read:
- Timeline of deadly explosions wey don shake Lebanon
- How Nigerian activists mark one year afta failed Revolution Now protest of 5 Aug. 2019
- Cameroon separatists 'bomb' military moto for Kembong
- Hospital di chase Nke Prisca, victim of Yaoundé explosion wey no fit pay her bills
- 'I dey dia wen Abule Ado explosion happun' - survivor
- Weti we know about number three explosion for Yaoundé
- How gas explosion kill pipo for Ajao Estate, Lagos