Lebanon explosion video: Di moment big blast hit Beirut di Lebanese capital
Rescue workers for Lebanon dey dig through di remains to check for survivors afta di terrible explosion for Beirut on Tuesday wey kill at least 137 pipo and injure about 5,000 others.
Some port officials don dey under house arrest for Lebanon as di kontri begin investigate wetin cause di deadly explosion.
Lebanon declare two week state of emergency as rescue workers dey search for more dan one hundred pipo wey miss afta di big explosion wey scata di port area of di capital Beirut on Tuesday.
Big explosion don hit and cause serious damage to di Lebanese capital city of Beirut, e cause ogbonge damage and many casualties. According to tori, di blast strong sotay dem feel am for Cyprus, island around 240km (150 miles) away.
Lebanon Prime Minister Hamad Hassan declare 5 August, 2020, as day of "national day of mourning".
Officials dey blame highly explosive materials wey dem store inside one warehouse for six years.

Di blast destroy di immediate dockside area, e create big hole of approximately 140 metres wide, wey flood with seawater.
Di warehouse wia di initial fire and explosions bin start dey completely destroyed and one grain silo wey near am dey heavily damaged.
Satellite images show di complete devastation for di port area, with one ship wey di blast blow out of water go di dockside.
Warning say dis video get pictures wey fit turn your belle.

