Lebanon explosion: What we know so far about di Beirut blast wey kill pass 100 pipo

Wetin we call dis Video, Beirut explosion video: Di moment big blast hit Lebanon capital
Read am in 3 mins

Rescue workers for Lebanon dey dig through di remains to check for survivors afta di terrible explosion for Beirut on Tuesday wey kill at least 137 pipo and injure about 5,000 others.

Some port officials don dey under house arrest for Lebanon as di kontri begin investigate wetin cause di deadly explosion.

Lebanon declare two week state of emergency as rescue workers dey search for more dan one hundred pipo wey miss afta di big explosion wey scata di port area of di capital Beirut on Tuesday.

Lebanon Prime Minister Hamad Hassan declare 5 August, 2020, as day of "national day of mourning".

Officials dey blame highly explosive materials wey dem store inside one warehouse for six years.

Graphic wey show before and after di explosion

President Michel Aoun tweet say e dey "unacceptable" say dem store 2,750 tonnes of ammonium nitrate in an unsafe manner..

Investigation dey under way to find out di exact tin wey trigger di explosion.

Reports say Hospitals don full and many buildings don destroy.

Map of explosion

Pipo for 240km (150 miles) away for di island of Cyprus for di eastern Mediterranean hear di blast.

Di explosion dey come for sensitive time for Lebanon, wia economic crisis dey bring up old divisions.

Dis explosion happun even as tension bin dey high ahead of di judgement for di trial on top who kill di former Prime Minister Rafik Hariri for 2005.

Dem don postpone di judgement.

Fire fighters dey try quench fire from di blast

Wia dis foto come from, Reuters

Lebanon health minister, Hamad Hasan say, many pipo many injure and plenty things destroy.

Local media show pipo wey dey trapped under blocks. One witness describe say di first explosion fit block ears.

Wetin cause di explosion?

According to report, dem store di ammonium nitrate for one warehouse inside Beirut port for six years afta dem unload am from one ship dem mpound for 2013.

Di head of Beirut port and di head of di customs authority tell local media say dem bin write give di judiciary several times , as dem ask make dem export di chemical or sell am to ensure di port safety.

Port General Manager Hassan Koraytem tell OTV say dem bin dey aware say di material dey dangerous wen one court first order make dem store am inside di warehouse, "but not to dis degree".

Lebanon Supreme Defence Council don vow say those wey dem find responsible go face di "maximum punishment" possible.

House arrest go apply for all port officials "wey handle di affairs of storing [di] ammonium nitrate, guarding it and handling di paperwork" since June 2014, Information Minister Manal Abdel Samad tok.

Before and after di explosion picture of di port side of Beirut

How big be di blast?

Di blast destroy di immediate dockside area, e create big hole of approximately 140 metres wide, wey flood with seawater.

Di warehouse wia di initial fire and explosions bin start dey completely destroyed and one grain silo wey near am dey heavily damaged.

Satellite images show di complete devastation for di port area, with one ship wey di blast blow out of water go di dockside.

More fotos from di scene of di explosion

Victims from Beirut explosion

Wia dis foto come from, Getty Images

Victims from Beirut explosion

Wia dis foto come from, Getty Images

Pipo wey injure wey hospital

Wia dis foto come from, Getty Images

Official dey help one of di injured pesins

Wia dis foto come from, Getty Images

Beirut explosion

Wia dis foto come from, EPA

Scene of di accident for Beruit

Wia dis foto come from, Reuters

Belruit explosion

Wia dis foto come from, Reuters

Beruit explosion

Wia dis foto come from, EPA

Dem don close di port wey di explosion take happun

Wia dis foto come from, EPA

Beruit explosion

Wia dis foto come from, Getty Images

Di Ministry of Health tweet say dem don instruct hospitals to attend to those wey injure and na goment go pay for dia treatment.

Numbers of pipo wey injure still dey enta.

Hadi Nasrallah wey di accident happun for im eyes tell BBC say, for some seconds, im no dey hear word again. He say di explosion dey very scary and e dey very loud.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post