Audi car manufacturer comot 'insensitive' advert wey show pikin dey chop banana

Wia dis foto come from, @AudiOfficial/Twitter
German company wey dey manufacture, Audi don apologise for dia advert wey show small pikin dey chop banana in front of one of dia ogbonge car. Dis one cause serious gbas gbos for dem on Twitter as pipo begin yab dem.
"We don hear you and make we set am straight: We care for children," Audi tweet dia apology.
"We dey sincerely sorry for dis insensitive foto and we go make sure say we no use am in future."
Pipo wey criticise dey hala say di pikin pose "dey provocative" and fit threaten life.
Some odas say di driver no go fit see di child wey pose, dey lean for di car bodi.
Others tok say di foto dey sexually suggestive, as dem see bananas and sports cars as symbols of man wey like sex.
Audi slogan in English wey dey ontop di foto tok: "Lets your heart beat faster - in every aspect."
Di company say dem don begin investigate how dem publish di advert.
End of Di one wey oda users dey read well well
For May, Volkswagen moto wey di German company dey also produce, also enta similar gbege for social media. Dia advert show one foto of how di hands of white women dey move one black man around before dem troway di man inside one yellow VW Golf before dem turn on one kain music.
Di full ad for the Audi RS 4 on di company website dey show say dem dey market di car as family car - and dat na di context for di Twitter advert wey show di small pikin dey chop banana.
Jane Bradford also tweet under di Audi apology: "So, make your heart beat very fast for evri aspect? Foto of - child wit banana for mouth and flash car- so wrong for EVERY aspect".
Shiri@home tweet: "Little girl wit one symbol in her hand. Clear, super..."
And DjBeeTee tweet: "Make we summarize evritin up: Red=eroticism, sports car=substitute for potency, animal print mini-skirt=sex appeal, banana=phallic symbol. But sure dis all just dey accidental..."
However, Mark Kreuzer, one engineer and blogger, tweet: "Hmm, well for me di message na: Audi RS4 = family car. Just as your own daughter make your heart beat faster, na so di RS4 be. And both dey really cool."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post














