Shoprite leaving Nigeria and Tayo Amusan: Latest news about di retail company divestment

latest news about shoprite

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Shoprite storefront in Abuja, Nigeria

No be news again say Shoprite, wey be Africa largest retail chain, don announce say dem don decide to divest alias cari dia money comot from dia Nigerian retail branch, Retail Supermarkets Nigeria, wey be di owners of Shoprite Supermarket Nigeria.

Latest gist be say di Nigerian officials of di global Shoprite business dey insist say na only internal expansion process dem wan do, contrary to wetin odas wey sabi dem within and outside Nigeria dey yan.

Shoprite on Monday clear di mata say dem just wan transfer di retail business for Nigeria wey fit worth up to 25 billion Naira to new owners wey be Nigerians.

Already business insiders say na three companies dey eye di take over bid for Shoprite Nigeria and Tayo Amusan name na im many pipo dey call.

Shoprite leaves Nigeria

Wia dis foto come from, Shoprite

Dis na wetin we know about Tayo Amusan

Na 60 year old billionaire and Nigerian investor.

Oga Amusan na promoter of Shoprite long before now - Some of im properties na im dey house di stores of Shoprite across di west African nation.

Tayo Amusan na real estate investor and dey married to im wife Ayo Amusan.

Tayo Amusan and im wife Ayo

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Tayo Amusan and im wife Ayo

Im currently be di Chairman and Managing Director of Persianas Nigeria Limited, wey dey develop luxury residential, retail, entertainment and hospitality centres as well as commercial developments in Nigeria. since 1990.

Na him set up The Palms Mall - Afta e successfully make di The Palms tanda for Lagos in 2004, oga Tayo set up three additional malls in Enugu, Kwara, Ota and Ibadan.

Amusan dey also serve on boards of several companies, including Garages Limited and Southern Petroleum Limited.

On 31 July 2019, Tayo Amusan resign im position as a Director and Chairman of di Board of Directors of Resourcery Plc.

Tayo Amusan na Yoruba tribe e come from for Nigeria.

Shoprite leaving Nigeria after Woolworths Group - Retail company

Wia dis foto come from, SHOPRITE

Wetin we call dis foto, Shoprite yan for dia latest financial statement say di Xenophobic attacks wey happun for Nigeria for September, 2019 bin affect dem wella.

Shoprite retail company, wey be Africa number one supermarket chain, on Monday announce say dem dey consider to end dia business for Nigeria.

Di South Africa company, wey open dia first store for Lagos in 2005, say dem dey find buyer for dia business inside di West African kontri.

Shoprite na di latest South African retailer to consider leaving Nigeria - clothing firm Mr Price announced been announce dia exit in June, and Woolworths wey be anoda retail giant bin waka comot in 2014.

Shoprite Nigeria
Wetin we call dis foto, Shoprite Nigeria

Shoprite decision dey come at a time wen Nigeria economy dey struggling in di middle of di coronavirus pandemic

Dis go come as shock and surprise to many Nigerian shoppers and customers wey see Shoprite as one of di biggest supermarket for di kontri, especially as sign no show say dem dey struggle.

Inside di half-year company report wey dem release on 3 August, Shoprite say investors don dey offer to buy dia business so tey di board don reason am to sell.