BBNaija: Ozo, Dorathy na head of house and deputy for week 3 for Big Brother Naija 2020 season 5 show

Wia dis foto come from, Big Brother Naija/ Africa Magic
Ozo snatch di Head of House (HoH) seat from Lucy afta im win di HoH Challenge on Monday August 3 come nominate Dorathy as im deputy.
Im be di first man to win di HOH title afta Nengi and Lucy win am for dia first and second week for di house.
As Head of House, Ozo get automatic immunity for dis week eviction and exclusive access to di Head of House Lounge for di week.
Im also get power to pick deputy, first, second and third choice.
Ozo pick Dorathy as im first choice, Nengi as second and Erica as third choice.
Na Nengi bin win di first head of house challenge and during her reign, di house lose dia weekly wager.
As tins be, 16 housemates dey up for possible eviction dis week out of di 18 wey still remain for di house.
Di housemates don spend three weeks inside dia ten weeks journey for di house.
End of Di one wey oda users dey read well well
Housemates wey dey up for eviction
16 housemates dey up for possible eviction dis week out of di 18 wey still remain for di house.
On Sunday, Ka3na and Lilo comot for di house afta di first eviction show wey happun on Sunday.
See di full list:
- Victoria Adeyele AKA Vee
- Timmy Sinclair AKA Trikytee
- Terseer Kiddwaya
- Praise Nelson
- Florence Wathoni Anyansi
- Tochukwu Okechukwu AKA Tochi
- Kate Jones AKA Ka3na
- Eric Akhigbe
- Ngozi Nlewedim AKA Erica
- Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
- Aisha Umaru AKA Kaisha
- Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
- Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
- Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
- Rebecca Hampson AKA Nengi
Voting go start on Monday and end on Thursday August 6.











