Erica and Kidd video: BBNaija 2020 housemates 'entanglement' for di season five lockdown house

Erica and Kiddwaya

Wia dis foto come from, AFrican Magic website

Wetin we call dis foto, Erica and Kiddwaya kiss each oda afta di eviction show on Sunday
    • Author, Fiona Equere
    • Role, BBC News Pidgin
  • Read am in 2 mins

Fans of BigBrother Naija reality show dey drag Erica and Kiddwaya for social media afta video show two of dem dey 'play love' under dia bedsheet for di house on Sunday.

Di incident hapun afta di live eviction show for di reality television show.

Although dia actions no too shock fans, onto say, dem tell dia fellow housemates say dem like each oda and on different occasion Erica and Kidd don kiss.

Fans don even give di couple name 'kiddricca'.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Erica

Wia dis foto come from, Big Brother Naija/Africa Magic

Who be Erica?

Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London.

She say she dey passionate to be big time celebrity and like to get drunk and dance in front of di mirror alone.

Oda housemates wey don entangle for di show

Praise and Katrina

Praise and Ka3na

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic

Praise and Katrina entanglement video shock fans sake of say di two of dem no show any sign of relationship between dem.

Dat na why di video of two of dem for di same bed for night dey play with each oda under dia bed sheet shock fans well-well.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Lilo and Eric

BBCNaija Housemates: Eric and Lilo

Wia dis foto come from, BBNaija

Wetin we call dis foto, BBNaija housemates kiss during di first Saturday night party in Big Brother Naija Season 5 lockdown.

Lilo and Eric na d first ship wey sail inside di BigBrother Lockdown house. Di two of dem spend most of dia time for di house for each oda company.

And e no tay dem share dia first kiss togeda.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

During Lilo two weeks stay for di house, she share her bed with Eric and di couple play love wella under dia bed sheet.

On Sunday Big Brother evict Lilo and Ka3na from di house afta dia fellow housemates nominate dem afta dem get di least votes from di public.