Cameroon news: Yaoundé Rond Point Damas experience night explosion, number three inside two weeks - see wetin we know

Cameroon capital, Yaoundé, last night, count number three explosion from local bomb and na weti we know dis.
Kontri pipo for Rond Point Damas quarter for Yaoundé panic last night as local bomb explode.
Dis area, na junction and de explosion happen near wan bakery weh e get supermarket. Na busy place weh pipo di sell chop, roasted fish, fruits, and bars dem dis area for evening.
De explosion happen around 7:30 pm 'Ketou' policeman for Rond Point Damas police post tell BBC News Pidgin.
Five pipo wound, two bi serious and deh dey for Yaoundé central hospital.
Police say de explosion weh deh fit don provoke from far, na mixture iron rods 6 and 8 inches plus acid inside pressure cooker inside bag. De tie de cooker wit rope to moto-cycle battery.
Stephanie, nurse for Emmanuel clinic weh say de victim weh na woman bi get second degree burns-weh e mean say e bi serious.
De explosion burn e laps and wen deh bring e, Stephanie give do first aid treatment before police take e for hospital wit de odas.
End of Di one wey oda users dey read well well
Eye witness, Nathalie tok how e happen. Ah bi dey here (Rond Point Damas) weh ah hear, bum, ah fall, deh stand and shout my small broda, di run go for de fire, na wan papa hold me.
Luckily ma broda weh e bi di sell for dat spot run wen e happen.
But de woman (cassava seller-bobolo) too burn seriously as e bi shiddon na for place wen de put de bomb. Den de boy weh e bi di sell shoes also burn as e too bi dey for wusai de put de bomb.
As de fire go up afta explosion e pipo gada for stop'am with try, close and oda tins. One girl e clothes start burn, pipo komot de clothes pour e wata.
Police barricade de area for night. "Pipo no fit pass because we don block all roads for search all side and na for wuna good", one policeman explain for BBC News Pidgin.

One of de boys weh deh free afta arrest tell BBC say deh no sleep for night, deh force dem for sing.
Rond Point Damas explosion na number three afta Melen and Emana inside two week for capital city and kontri pipo di wanda if deh bi safe for Yaoundé for June 21. De explosions dem all na for night.
For June 27 police enta for de two quarters for wusai bomb bi explode, arrest pipo for inside four trucks but deh later free some weh deh get dia identity cards.
Pipo for Rond Point Damas tell BBC News say dia own don kam as police go search some houses, and arrest pipo.
"We fear na say wen police kam deh di take we cargo, TV, Fridge and odas tins weh no don loss receipts, deh tok".













