Tyrese Devon Haspil, Personal Assistant to Fahim Saleh, Gokada CEO dey arrested as suspect for di murder in New York

Wia dis foto come from, OTHER
Police don arrest di personal assistant to Gokada CEO wey dem cut im deadi bodi separate for one apartment inside di luxury condominium building on Manhattan Lower East Side on Tuesday afternoon, according to local report on Friday.
Fahim Saleh personal assistant, Tyrese Devon Haspil, age 21, dey expected to be charged for di killing of di young tech entrepreneur, according to two officials wey brief on di matter.
Na Oga Saleh sister discover di bodi around 3:30 PM on Tuesday wen she go check on am as she no hear from am for a day, officials tok say afta she find di bodi, she call di police.
Wen detectives begin investigate, dem find Saleh bodi without hand and leg wit one electric saw near am. Two law enforcement officials give di briefing say, dem later find di man head and limbs for di apartment, one Police Department toktok pesin tok am.

Wia dis foto come from, Instagram/@gokadang
Plenti plastic bags bin dey di apartment and e be like say e bin get efforts for pesin who wan clean up di evidence of wetin happun, one law enforcement officials wey dem brief on di mata tok.
Di police no immediately identify di man, but plenti friends wey speak on di condition say dem no wan mention dia name say na Fahim Saleh, one 33-year-old technology entrepreneur and di owner of di apartment wia dem find di bodi.
Haspil dey expected to be charged in a criminal complaint wit second-degree murder and oda crimes.
Tyrese Devon Haspil: Wetin dem find out about di Personal Assistant to Fahim Saleh
Oga Tyrese Devon Haspil bin do work for Mr. Saleh since im be 16, pipo wey sabi di investigation tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Oga Haspil bin serve as Oga. Saleh executive assistant and handled im money dem alias finances and personal mata dem, and e be like say im even owe di victim a significant amount of money," di chief of detectives, Rodney K. Harrison, tok for one brief news conference on Friday afternoon.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Detectives believe say di motive for di killing come from Oga Saleh wey discover say Oga Haspil don tiff roughly $90,000 from him, two officials familiar wit di investigation tok.
So Oga Saleh sack Oga Haspil, but no report di tiff money and even offer to set up wetin amount to a repayment plan so dat e fit return di money, di officials tok
One of di officials say Oga Saleh bin pay Oga Haspil so well wey be say im don fit dey able to pay off di debts of many family members
Haspil arrest happun on Friday at 8:45 a.m. for di lobby of one apartment building on Crosby Street in SoHo, wia im don dey stay wit one female friend, di official tok. New York detectives and federal agents from one U.S. Marshals Service regional fugitive task force na im take am into custody.
Investigators don conclude say Oga Saleh na on Monday afternoon dem kill am, di day before dem find im bodi, di fourth pesin wey be official wey sabi di investigation tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Afta di murder, di killer use one credit card to pay for one car to one Home Depot, wey dey for West 23rd Street inside Manhattan, and to buy cleaning supplies, di fourth pesin wey be official wey sabi di investigation tok. E return to Oga Saleh apartment di next day to dismember di bodi and clean up di crime scene, New York Times dey report.
Prosecutors say dem get enough evidence against alleged killer of Gokada CEO Fahim Saleh, The New York Daily News dey report.
Fahim Saleh biography
Friends of Oga Saleh describe am as an ambitious man wey dey exercise everi morning, get busy schedule of meetings and im dey travel well-well to Nigeria for business. He dey collect tech gadgets and he dey live alone wit a small dog, Laila, wey dem see for di apartment but im dey alive.
According to one 2016 blog profile, dem born Oga Saleh for Saudi Arabia and he dey move wit im family well-well before dem later settle for Rochester, New York and later dem settle for Poughkeepsie, New York.

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wia dis foto come from, Other
Saleh na di son of Bangladeshi immigrants, he learn how to code and begin develop apps as a teenager, im friends tok. After im graduate from Bentley University for Waltham, Mass., he invent PrankDial, app wey im create for making prank telephone calls.
Oga Saleh ride-hailing motorcycle start-up, Gokada, begin dey operate for Lagos, Nigeria, for 2018, and e raise $5.3 million in venture capital for June 2019, according to one website Techcrunch. Motorcycle taxis dey common for Lagos because dem fit enta and go through any traffic-clogged streets.
More details go land for dis page later, just dey refresh.













