Tolulope Arotile biography and di rise of Nigerian Airforce first female combat helicopter pilot

Late Tolu Arotile wit Minister of Women Affairs Pauline Tallen

Wia dis foto come from, NIGERIAN AIR FORCE HQ/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Late Tolu Arotile wit Minister of Women Affairs Pauline Tallen
    • Author, Annette Arotiba & Mansur Abubakar
    • Role, BBC News Pidgin
  • Read am in 4 mins

Nigerians dey react to di shocking news of di death of Tolulope Arotile, Nigeria first ever female combat helicopter pilot wey die on 14, July, 2020 for di Nigerian Airforce base for Kaduna, north west Nigeria.

According to one statement from di Airforce, di young flying officer die from head injury wey she get from di road accident wey happun for NAF base Kaduna.

Dem born Flying Officer Tolulope Oluwatoyin Arotile on 13 December 1995 to di family of Mr and Mrs Akintunde Arotile for Kaduna state.

She come from Ijumu Local Government Area of Kogi State.

She attend Air Force Primary School, Kaduna from 2000 - 2005 and Air Force Secondary School, Kaduna from 2006 - 2011 before she later gained admission into diNigerian Defence Academy, Kaduna as a member of 64 Regular Course on 22 September 2012.

Her former classmate, seatmate and friend Musa Muhammad tell BBC say, her death dey very sad since she bin get very promising career for front of her for Nigerian Airforce.

Musa and Tolu wey both attend Nigeria Airforce Primary school for Kaduna and still maintain dia friendship till adulthood. As she choose career for Nigerian military, Musa go study chemistry for Usmanu Danfodio University for Sokoto but im and Tolu neva lose touch till she die.

"Tolu's death dey very painful to me because she get very promising career for her front for Nigerian Airforce, she dey very smart and focused since from primary school."

Air Marshall Abubakar say Tolelope na very intelligent, discipline, confident and courageous younfg officer

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Tolulope Arotile as squadron pilot in operation for GAMA AIKI in Minna, Niger State

"I dey always tease her about her height even in for last chat, I dey tell her say hope you don grow one inch taller and she just laugh and respond say wait till you see me."

Musa say dia last chat na wen e write article about coronavirus cases for Kano and she come respond to wetin im write.

"From primary school she show say she love military and dey interested dis na why wen she enter Airforce Secondary school. She join di cadet force to show say military na wia her mind dey." Muhammed tok.

Late Tolulope Arotile and di Minister of Women Affair Pauline Tallen

Wia dis foto come from, NIGERIAN AIRFORCE/TWITTER

Wetin we call dis foto, Late Tolulope Arotile and di Minister of Women Affair Pauline Tallen

How Arotile rise to make history as Nigeria first female combat helicopter pilot

Di late flying officer na native of Iffe area in Ijumu Local Government Area of ​​Kogi State,

She die on 14 July 2020, less than eight month wey dem decorate her.

Arotile say she join di military because of her passion for di military. She say to be military personnel na her long time ambition, di carriage and wetin dem stand for dey exceptional.

See how her career waka

  • Tolulope grow up for Kaduna state and she begin her military journey from when she small. She attend di Nigeria Airforce Primary school for Kaduna.
  • From there she go Airforce Secondary school and she join di cadet to show say all her mind na military e dey.
  • Flying Officer Tolulope Arotile get admission into di Nigerian Defence Academy on 22nd September 2012 where she get Bachelor of Science degree in Mathematics.
  • Dem commission her into di Nigerian Airforce for 16 September 2017 as a member of di Nigerian Defence Academy Regular Course 64.
  • She hold commercial pilot license and also underwent tactical flying training for di Agusta 109 Power Attack Helicopter in Italy.
  • For October 2019, di Nigerian Air Force bin decorate her as di first female pilot wey di service go get in 55 years.
Late Tolu Arotile wit Chief of Air Staff, Sadique Abubakar

Wia dis foto come from, NIGERIAN AIRFORCE/TWITTER

Wetin we call dis foto, Late Tolu Arotile wit Chief of Air Staff, Sadique Abubakar

Di Chief of Air Staff, Sadique Abubakar for di ceremony say "out of di 13 pilots wey qualify for di ogbonge award of di NAF wing, two of dem na female". Di first female fighter pilot winged na flying officer Kafayat Sanni and di first female helicopter pilot na Tolulope Arotile.

During her short stay for di service, di Nigerian Air Force say late Arotile contribute well to destroy armed bandits wey dey di North Central States and other criminal elements by flying several combat missions under Operation GAMA AIKI in Minna, Niger State.

More reactions to her death

Flying Officer Tolulope Arotile wey die inside road accident

Wia dis foto come from, Alamy

Wetin we call dis foto, Flying Officer Tolulope Arotile wey die inside road accident

Di news of her death touch many pipo as politicians di Speaker of di Nigeria House of Representative Femi Gbajabiamila, Senator Shehu Sani, her friend, di Chief of Air Staff and other Nigerians don react to di news.

Di Chief of Air Staff Sadique Abubakar for twitter say im remember di time im meet her for one operational visit, she show eagerness to bring lasting peace to di North wey get security challenges. He say her death na huge loss to di Nigeria Air Force, her family and di entire nation.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4

Skip X post, 5

End of X post, 5