Tolulope Arotile: How Nigeria Airforce first female combat helicopter pilot take die

Wia dis foto come from, NIGERIAN AIRFORCE/TWITTER
Di first ever female combat helicopter pilot for di Nigerian Air Force Tolulope Arotile don die.
Di Nigerian Air Force wey announce am for dia twitter handle say di young flying officer die from head injury wey she get from di road accident wey happun for NAF base Kaduna.
24 year old flying officer Tolulope Arotile die on 14 July 2020 according to di Nigerian Air Force wey announce her death.

Wia dis foto come from, Nigerian Air Force
Dem commission officer Arotile into di Nigeria Air Force for September 2017 as a member of di Nigerian Defence Academy Regular Course 64 and she be di first ever female combat helicopter for di service.
During her short stay for di service, di Nigerian Air Force say late Arotile contribute well to destroy armed bandits wey dey di North Central States and other criminal elements by flying several combat missions under Operation GAMA AIKI in Minna, Niger State.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di Chief of Air Staff, Air Marshall Sadique Abubakar on behalf officers, airmen, airwomen and civilian staff of the NAF, commiserates with di family of late Flying Officer Arotile on top dis big loss.

Wia dis foto come from, NIGERIAN AIRFORCE/TWITTER
How Tolulope take die
Di Director of Public Relations and Information for Nigerian Air Force, Ibikunle Daramola for inside statement say na one of her former secondary school classmate wey dey happy to see her wan reverse to greet her, na so di accident wey lead to her death happun.
End of Di one wey oda users dey read well well
One of her very close friend wey also follow BBC tok say na very minor accident kill her. He explain say pesin wey know her bin reverse back to greet her as she dey waka for road, e be like say e lost control of di motor, na so di accident take happun.
He say "she get smile on her face through out di time she dey receive treatment for hospital before she die."

Wia dis foto come from, Nigerian Airforce
Di friend wey still dey mourn her death as e dey show for im voice say Tolu na very intelligent girl, she always dey on top for everything she do, whether na for academics or her career.
He describe her as pesin wey dey devoted to God, she hold several appointments for fellowship during her school days, she dey kind and no dey proud wit all her plenty achievements.














