Gokada CEO Fahim Saleh murder in New York - Before di tech entrepreneur death, see fotos of im life & times in Nigeria

Gokada CEO Fahim Saleh hold Children's day party to celebrate some Nigerian children for gokada

Wia dis foto come from, Instagram/ fahims

Wetin we call dis foto, Fahim hold Children's day party to celebrate some Nigerian children for Gokada office
    • Author, Olaronke Alo
    • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 2 mins

Before New York police find Fahim Saleh dismembered body inside di luxury Manhattan Condo, di 33 year old Gokada CEO bin dey travel frequently to Nigeria wia e bin spend time wit tech community.

But on Tuesday 14 July, di sad news land say dem don kill Fahim Saleh for im apartment wia dem don use electric saw to cut im bodi.

Now, New York Police Department dey investigate wetin dem consider to be possible homicide, following Fahim Saleh suspected murder. But before all dis wahala land e go make sense to just check out di good times im bin spend.

Fahim Saleh bin experience some happy moments in Nigeria

Gokada CEO Fahim Saleh dey always smile

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Di always smiling Fahim Saleh attend one tech event wit oda tech entrepreneurs from Techcrunch
Fahim pose wit di G-Unit , di security unit wey dey work for Gokada company

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Fahim pose wit di G-Unit , di security unit wey dey work for Gokada company
Fahim Saleh country of birth na Saudi Arabia and im ride wit one of di gokada riders for Lagos

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Oga Saleh dey ride wit one of di gokada riders for Lagos
Fahim Saleh wit workers from Gokada

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Fahim Saleh dey always refer to im colleagues as 'Family'
CEO of Gokada wit some of Gokada workers for 2018 in Lagos Nigeria

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Fahim wit some of Gokada workers for 2018 in Lagos Nigeria
Gokada founder wit Gokada colleagues

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, February 2018, Di Gokada CEO wit im colleagues wen im launch di motorcycle hailing ride app in Lagos Nigeria
Fahim Saleh take foto wit one Nigerian man wey im meet for tennis court for Lagos

Wia dis foto come from, Instagram/ Fahim Saleh

Wetin we call dis foto, Fahim Saleh take foto wit one Nigerian man wey im meet for tennis court for Lagos

Afta Lagos State gomen place ban on motorcycles popularly referred to as Okada, Fahim Saleh business for Nigeria dey affected.

Di Gokada CEO wey almost dey cry, post final video on im Instagram page for February to plead for Lagos State goment to allow entrepreneurs to grow for di state.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Fahim Saleh biography

Wia dis foto come from, Twitter/ Fahim Saleh

Fahim saleh biography

Friends of Oga Saleh describe am as an ambitious man wey dey exercise everi morning, get busy schedule of meetings and im dey travel well-well to Nigeria for business. He dey collect tech gadgets and he dey live alone wit a small dog, Laila, wey dem see for di apartment but im dey alive.

According to one 2016 blog profile, dem born Oga Saleh for Saudi Arabia and he dey move wit im family well-well before dem later settle for Rochester, N,Y and later dem setlle for Poughkeepsie, N.Y.

Saleh na di son of Bangladeshi immigrants, he learn how to code and begin develop apps as a teenager, im friends tok. After im graduate from Bentley University for Waltham, Mass., he invent PrankDial, app wey im create for making prank telephone calls.

Oga Saleh ride-hailing motorcycle start-up, Gokada, begin dey operate for Lagos, Nigeria, for 2018, and e raise $5.3 million in venture capital for June 2019, according to one website Techcrunch. Motorcycle taxis dey common for Lagos because dem fit enta and go through any traffic-clogged streets.