Gokada CEO Fahim Saleh torso and dismembered dead body na im New York Police find for im apartment - See how di murder of di Pathao oga happun for im condo

Gokada CEO Fahim Saleh

Wia dis foto come from, Twitter/ Fahim Saleh

Read am in 4 mins

Dem find a man body wey dem don cut separate for one apartment luxury condominium building on Manhattan's Lower East Side on Tuesday afternoon, officials tok.

Wen detectives begin investigate, dem find di man bodi without hand and leg wit one electric saw near am.two law enforcement officials give di briefing say, dem later find di man head and limbs for di apartment., one Police Department toktok pesin tok am.

Plenti plastic bags bin dey di apartment and e be like say e bin get efforts for pesin who wan clean up di evidence of wetin happun, one law enforcement officials wey dem brief on di mata tok.

Di police no immediately identify di man, but plenti friends wey speak on di condition say dem no wan mention dia name say na Fahim Saleh, one 33-year-old technology entrepreneur and di owner of di apartment wia dem find di bodi.

Na Oga Saleh sister discover di bodi around 3:30 p.m. wen she go check on am as she no hear from am for a day, officials tok say afta she find di bodi, she call di police.

Dem plug di saw into one electrical outlet wen di police arrive, na im make di leading detectives to investigate whether na sake of di arrival of Oga Saleh sister for di apartment, na im make di killer run comot through di exit, one of di law enforcement officials tok.

Di medical examiner neva officially determine wetin cause di death, but police dey investigate di incident as homicide, di officials tok.

One of di law enforcement officials said one surveillance camera bin capture video of Oga Saleh for inside di building elevator wit anoda pesin wey dey wear black suit and black mask.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

For inside di video, di elevator door open and Oga Saleh enta into di apartment, di official tok. Di pesin wey wear di mask dey follow am directly for back, and di two immediately begin dey struggle, di official tok.

Dem see di sister for di video dey arrive di house short time after then. E get anoda way out of di apartment through a service entrance, di official tok.

Gokada CEO Fahim Saleh murdered in New York

Wia dis foto come from, Twitter/ Fahim Saleh

Friends of Oga Saleh describe am as an ambitious man wey dey exercise everi morning, get busy schedule of meetings and im dey travel well-well to Nigeria for business. He dey collect tech gadgets and he dey live alone wit a small dog, Laila, wey dem see for di apartment but im dey alive.

According to one 2016 blog profile, dem born Oga Saleh for Saudi Arabia and he dey move wit im family well-well before dem later settle for Rochester, N,Y and later dem setlle for Poughkeepsie, N.Y.

Saleh na di son of Bangladeshi immigrants, he learn how to code and begin develop apps as a teenager, im friends tok. After im graduate from Bentley University for Waltham, Mass., he invent PrankDial, app wey im create for making prank telephone calls.

Oga Saleh ride-hailing motorcycle start-up, Gokada, begin dey operate for Lagos, Nigeria, for 2018, and e raise $5.3 million in venture capital for June 2019, according to one website Techcrunch. Motorcycle taxis dey common for Lagos because dem fit enta and go through any traffic-clogged streets.

Oga Saleh tell TechCrunch im dey plan to use di moni to expand Gokada fleet and offer goods and services to im drivers.

"We go start a Gokada club for each of di cities wit one restaurant wia drivers fit relax, and we go experiment wit Gokada Shop, wia drivers fit get things wey dem need on a regular basis, like plantains, yams and rice," Mr. Saleh tell TechCrunch.

Gokada CEO Fahim Saleh establish di hailing app for 2018.

Wia dis foto come from, Twitter/ Fahim Saleh

Di building wia dem find Oga saleh bodi na for 265 East Houston Street near Suffolk Street, na 10-story, glass-and-brick structure wey dey among di high-end residential buildings for dat area.

Apartments for di building dey get Italian marble kitchens and master baths, white oak floors and di price dey between $2 million to $2.5 million, according to wetin dem gather from real estate website StreetEasy.

For Tuesday evening, detectives and officers, including some wit di Emergency Service Unit's canine team, seal di corner of East Houston and Suffolk Streets.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

As some officers stand for front of di building, anoda officer carry one German shepherd back and forth near di building, as di dog dey smell garbage bags and a side entrance.

Reporters and cameramen stand for Houston Street and across from di building on Suffolk, while patrons dey for di outdoor dining area of one Suffolk Street bar.

Leslie Feinberg, wey get di bar wit Brian Grummert, tok say as "a nosy neighbor," she bin don waka go look wen police cars, ambulances and fire trucks arrive for di apartment building several hours earlier.

"I see one young woman dey worried" for di lobby, Ms. Feinberg tok.

"From my understanding, na she find di victim," Ms. Feinberg tok, she add am say men wey she see as detectives later come lead di woman away from di scene.

Ms. Feinberg say she sbai may pipo wey dey live for di building during di three years wey she operate di bar, she say dem dey mostly well-off professionals wey dey like 30 years and 40.

Word spread quickly say something bad don happen for di apartment building, she tok.

"Dis neighborhood dey very close togeda," she tok. "Before you know, everybodi don sabi wetin happun."

Ms. Feinberg say she dey "totally shock."

"Sometimes you forget say New York City na New York City sometimes," she tok.

You like to watch dis video of Gokada female rider wey go ginger you:

Wetin we call dis Video, ‘Wen dem ban okada, e bi like say my enemy life end’ - Sandra di Lagos okada girl.