Goodluck Jonathan: Economic Communality of West African States want Nigeria former President to bring peace to Mali

Wia dis foto come from, Getty Images
Goodluck Jonathan, former Nigerian President don land anoda international appointment.
Economic Community of West African States (ECOWAS) don appoint Jonathan as special envoy to Mali to help bring peace to di political crisis wey dey worry di kontri.
Dem dey expect president Jonathan to discuss wit di main political actors for di kontri including President Ibrahim Boubacar Keita and top religious leaders in order to solve di problems.
E no too tay wey Mali enter political crisis wia recent protest by some pipo dey call on President Keita to step down from im position over issues wey dey trouble di kontri and im election wey dem say no dey fair.
Wetin dey give di protesters additional ginger na di ethnic and religious clashes wey dey happun for di kontri, dem say dis na why President Keita suppose go.
"I wan use dis opportunity after consulting our chairmo President Muhammadu Issoufou to appoint you (President Jonathan) as special envoy to help di problem wey dey happun for Mali." Dis na wetin di letter to Pres. Jonathan wey Mali newspapers publish carry.
President Jonathan get plenti praises and reputation as a peace maker after e no contest im 2015 election result with President Muhammadu Buhari.







