Joy Nunieh biography, husband and wetin we sabi about di NDDC former MD wey dey kwanta Godswill Akpabio, Minister of Niger Delta

Wia dis foto come from, RVGH
Joy Nunieh na di daughter of di first pesin to become lawyer for Ogoni land inside Niger Delta region of southern Nigeria.
Dr. Nunieh chop sack for February 2020 as NDDC Oga for insubordination afta she assume office as di Acting Managing Director of di Niger Delta Development Commission (NDDC) for October 2019.
Nunieh na River State indigene, one of di reasons why Govnor Nyesom Wike rescue her from arrest wen she bin dey travel go Abuja to for di NDDC probe.
Joi Yimebe Nunieh na im be her real full Ogoni name but many pipo dey call her Joy Nunieh.
Before she join di NDDC, she bin serve as di National Coordinator of Hydrocarbon Pollution Remediation Project, (HYPREP) for 2012.
HYPREP na institution wey dey under di Federal Ministry of Environment to do di following work for Ogoni land and oda communities wey suffer damaging oil pollution:
- To determine di scope, means and ways to stop environmental damages wey dey happun for di communities
- To do awareness on how to make sure say pipo around di community get better environment and livelihood.
- Dem go also promote peace building efforts for di communities
- Part of dia work na to strengthen governance, transparency and accountability for di region.

Wia dis foto come from, Joy Yimebe Nunieh/Facebook
For her inauguration she tok: "We dey here because Mr. President expect us to do proper forensic audit of dis commission from 2001 to date. we no go compromise and di pipo go know say, new team don come to work."
Joy Nunieh biography
Dr Joi Yimebe Nunieh na di fourth daughter of di first Senator and lawyer from Ogoniland, Late Sen. Cyrus Nunieh, from Beeri Khana local goment area.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na 11 November na im dem born Nunieh and she be chief alias Gbene wey dem dey call di Esther of Ogoni land.
Joy Nunieh Husband: E no dey clear weda she dey married as at today, but many pipo dey address her as Ms Nunieh - wey fit mean say she dey separated but BBC Pidgin understand say she get pikin.
Joy Nunieh Education: She study law for Rivers State University of Science and Technology RSUST, Port Harcourt.
Madam Nunieh bin attend University of Port Harcourt for her undergraduate studies.
On January 30, 2020, one civil society organization, Anti-Corruption and Accountability Coalition Against Corruption write petition to President Muhammadu Buhari say di den Acting Managing Director of NDDC Joy Nunieh forge her certificates dem.
Di group allege say Nunieh go get Police Extract from di Nigerian Law School Police Station about di loss of her documents to allow her go any court of law to swear affidavit.
Di group say according to di affidavit wey she swear, she say, "Upon di death of my sister Barr. Mrs. Ledee Ndorbu- Ebenezer wey die on 19 April, 2002 for her house at Doctor's Quarters for Braithwaite Memorial Hospital, Port Harcourt, Rivers State, her husband, Dr Zaccheus Ndorbu Ebenezer refuse to grant me access to her safe and refuse to hand over all my Educational documents including my call to bar certificate, NYSC call up letter and certificates, University Certificates and oda valid documents wey bin dey in custody of my late sister Barr. Mrs. Ledee Ndorbu-Ebenezer and evri effort to recover di documents listed above prove abortive till dis day."
Dem add say one letter from di Council of Legal Education claim say Ms Nunieh mobilize for National Youth Service Corps NYSC programme for 1989/1990 service year. But, letter by di National Youth Service Corps wey dey signed by Okonofua, K. N (Mrs), di Director of Corps Certification for di Director General say, "However, no record exist either for NYSC Kwara State or NYSC National Directorate Headquarters to show evidence for her participation for di Scheme."

Wia dis foto come from, RVGH
Joy Nunieh Career:
From Joy Nunieh LinkedIn profile we gather say; Joy Nunieh be independent contractor for Shell petroleum company for 11 years from 2008-2019.
Nunieh na private contractor for 30 years for Chevron Oil Nigeria Limited from 1989-2019.
She bin don contest for di House of Representatives seat to represent Khana /Gokana federal constituency.
Joy Nunieh sacked at NDDC and kwanta wit Godswil Akpabio:
Madam Joy Nunieh serve as Acting managing Director of di NDDC within just four months before dem sack her for February. She accuse di Niger Delta affairs minister Godswill Akpabio say im get hand for her removal from office and na because she no gree sign oath of secrecy to all di mago-mago im dey do for di commission.
For one interview wit tori pipo, she also accuse di minister of bombing pipelines make dem for fit sack her from office.
But Oga Akpabio say dem sack Madam Joy sake of insubordination, Akpabio tok am wen he feature on AriseTV News Saturday night.
"My ministry wey dye supervise her write several letters to her but she no respond to anyone," he tok.
Di minster say im don also receive petition from one petitions from one anti-corruption agency say Nunieh no get di rcorrect qualifications to work as di acting MD of a commission.
Di Nigeria House of Representatives don summon di fmr Acting NDDC Oga to Abuja for investigative hearing on corruption matter and oda tins wey dey happun for di NDDC.
However, on Thursday morning some armed security men enta her house to arrest am before Rivers State governor, Nyesom Wike rescue her from di operation.















