Joy Nunieh: Nyesom Wike say "I no go fit dey and see any Rivers Daughter suffer"

Nyesom Wike on Joy Nunieh mata

Wia dis foto come from, RVGH

Wetin we call dis foto, Joy Nunieh mata na im Wike address on Thursday.
    • Author, Karina Igonikon
    • Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
  • Read am in 2 mins

Joy Nunieh, di NDDC former Managing Director don beat chest tok say she get defender wey be her govnor afta heavy security storm her house on Thursday and now her govnor Nyesom Wike don explain why im dey defend her.

"I no go fit dey and see any Rivers Daughter, Rivers citizen suffer."

Na wetin di Rivers State Govnor say make am go rescue di former Managing Director of NDDC, Dr. Joy Nunieh from her house for Port Harcourt wia heavy security storm for viral video.

Some security agents bin surround Dr. Nunieh house for early morning no let her comot as she bin wan travel to Abuja to appear before di National Assembly for di ongoing probe of di NDDC.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Govnor Nyesom Wike

Wia dis foto come from, Joy Nunieh: Godswill Akpabio mata provoke Wike

Governor Wike say e no dey proper for security pipo to just go surround her house or arrest her like common criminal but if dem get any allegation against her na for di security pipo to invite her come dia office.

"We no dey interested as we no go support any crime for corruption for NDDC but evritin must follow procedure and I no know who dey involved or who dey interested but make nobody push Rivers State to di point wey we go say enough is enough because we don come out say we go protect our daughter. No be only her, we go protect any pesin wey be citizen of Rivers State."

Joy Nunieh sacked from NDDC and dis na her house as di mata dey happun

Wia dis foto come from, Ivy Etokakpan

Wetin we call dis foto, Joy Nunieh house as di mata dey happun

Govnor Wike say im no like di way tins dey go for di kontri as e dey wrong for police to storm pesin house like dat, without any warrant of arrest.

Di govnor say im ask di Rivers State Commissioner of Police, Joseph Mukan and di commissioner say im no dey aware of di matter so im wonder how somtin go happen for im State and di Police Commissioner no dey aware but dem say na Inspector General (IG) Monitoring Unit and im sure say di Inspector General of Police sef no dey aware.

BBC Pidgin don call both di Force PRO on dis mata but as at 5pm no bodi for Nigeria police don explain anytin to clear di mata.

Joy Nuineh mata wey Arise TV sho Live make Gov N.E Wike address di press.

Wia dis foto come from, Twitter/ Gov N.E Wike

Di Rivers Govnor come ask di Governor of Akwa Ibom say if im know who dey responsible for wetin happen, make im call di pesin to order, or any pesin for all di Niger Delta States, make dem call dia pipo to order and leave Nunieh alone. Di Govnor come ask di Inspector General of Police to investigate dis matter.

Editor's note: Joi Yimebe Nunieh na im be her real full Ogoni name but many pipo dey call her Joy Nunieh.